You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
University of Calabar suspend dean faculty of law ova alleged sexual abuse
- Author, Adebola Ajayi
- Role, BBC Journalist
Di management of University of Calabar (UNICAL) don suspend and ban di dean of faculty of law, Professor Cyril Ndifon from di campus ova allege sexual abuse against undergraduates for di institution.
Di institution direct di dean make im handover all im property as di suspension go take effect on 17 August, 2023.
Following di public outcry for social media ova di protest of undergraduates for di faculty of law as dem gada for Monday to express dia displeasure on di sexual harassment wey di dean of di faculty dey do.
Di protesting students – mostly female carry placards wey dem write different tins on top, “Enough of law school list manipulation”, faculty of law no be “brothel”.
But di dean of di faculty of law, University of Calabar, Professor Cyril Ndifon deny di allegations against am.
E say na pipo wey no like as im dey hold di position as dean dey drag im image for mud.
Di university announce for dia Twitter page on Thursday say dem don suspend Professor Cyril Ndifon for di violation of di institution policies.
Di management of UNICAL tok say dem don relieve di dean from all im duties and place am on suspension while di institution panel begin investigate di allegations against di dean.
End of Di one wey oda users dey read well well
“Handover all di university properties wey dey im possession including all official responsibilities to di Sub-Dean of the faculty bifor e vacate office,” di University tok
“You go stay away from di university premises except while you respond to invitation from di panel wey dey investigate dis allegations.”
Despite di high rate of sexual misconduct, assault and exploitation for universities many Nigeria universities still dey ignore di menace of “rape culture” among lecturers and students.
Dis na sometin wey dey mostly happun for university campuses due to say di students no dey gree complain or maybe dem no get evidences ab idem no even trust disciplinary processes.
Recently Law students for di University of Calabar wey dey for Cross River state, south south Nigeria protest against dia dean.
Tori of dia protest go viral sake of di kain tins dem write for di placards wey dem carry. Dem accuse di lecturer of sexual harrassment.
For Nigeria, how universities dey deal wit sexual misconduct and exploitation dey unregulated becos ogbonge law wey dey protect students neva dey.
Though some universities get disciplinary procedures and guidelines wey dey investigate and tackle sexual misconduct cases or complaints for dia universities, e no dey effective.
While Nigerians still dey wait for di implementation of di Sexual Harassment of Students in Tertiary Educational Institutions Prohibition Bill (2019), professor Ndifon say di latest accuse against am dey baseless.
E say na pipo wey no like as im dey hold di position as dean dey drag im image for mud.
“Dis allegations dey baselessly masterminded by my detractor wey don vow say dem go drag my image to di mud just because I win di faculty elections two times,” di prof tok.
E add say “Pesin fit harass girls without di ladies coming out to raise di alarm dat they sexually harass dem?
“Dis na why I tok say di allegations na lie, cooked from di pit of hell, just to destroy di reputation wey I don build for decades.”