You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Uganda president reply World Bank ova anti-LGBTQ+ law
Following di sanction wey di World Bank sama Uganda ova Anti-Homosexuality law, president Yoweri Museveni tok say dem no need pressure from anybody to solve problem wey dey dia society.
President Museveni add say di statement of World bank to suspend any new requests for loan from Uganda sake of say dem sign di anti-LGBTQ law dey very “unfortunate and coercive”.
On Wednesday, one statement bin comot from World Bank say dem no go approve any finance for Uganda becos say di law wey dem enact dey against di value of di body.
Di World Bank explain for dia statement say dia vision na to eradicate poverty for evri wia for di planet and na only wen e no dey restricted to any gender go make am dey successful.
“Inclusion and non-discrimination dey di heart of our work around di world and di law dey undermine our effort becos e dey contradicts our values,” World bank tok.
For im reply to World Bank, Uganda president Museveni say di kontri go “develop wit or without loans.”
“We no need pressure from anybody to know how we go solve our own problems for our society.
“E dey unfortunate say di World Bank and oda actors wan try force us to abandon our faith, culture, principles and sovereignty, using money.”
End of Di one wey oda users dey read well well
Na since May Uganda bin sign di anti-LGBT (same sex relations) law wia dem impose death penalty for offenders and e don bring different sanctions ontop dem but president Museveni tok say World Bank dey “ really under-estimate all Africans.”
Di Uganda president reveal say im kontri go continue to dey tok wit di World Bank to see if e dey possible to avoid wetin im describe as diversion.
Wen di law bin dey enacted for Uganda, World bank reveal say dem send team go di kontri to go review di situation and how e go affect dem and e dey clear say dem go need “additional measures” to carry out any projects wey go align wit dia social and environmental standards.
World bank add say, “Our goal na to protect sexual and gender minorities from discrimination and exclusion for di projects wey we dey finance.”
Di new measures against Uganda currently dey under discussion wit di authorities, according to wetin di ogbonge bodi tok for dia statement.
Clearly, World Bank bin also mention say dem go test all di additional measures make dem confam say e dey effective. Until den, di bodi no go present any new public finance from Uganda to dia Board of Directors.
Uganda no dey comfortable wit sanction becos dem believe say no be only dem don pass di law.
According to di Uganda state minister for foreign affairs for Uganda Okello Oryem, di decision of World Bank dey unjust to dem becos say oda kontris also get di law.
"E get many Middle East kontris wey no dey tolerate homosexuals, some dey even hang dem. For di US, e get many states wey don pass di law as dem dey restrict pipo wey dey involve for same sex relations. Why be say na Uganda dem come dey pick on.”
Di Uganda representative to the United Nations, Ambassador Adonia Ayebare tok say na di best time wey dem go rethink di decision of World Bank be dis. Im add say di move by di ogbonge bodi no dey favourable and Ugandans need to start to dey rethink di decision of di board.
Homosexuality for Uganda and oda kontris
Uganda no be di only kontri wey dey punish pipo wey dey involve for same sex relations. Na about 63 oda kontris don enact punishment for offenders.
However, na Africa get di highest numbers of kontris wey don enact anti-LGBTQI law.
Kontris wey don sign di law include Afghanistan, Algeria, Bangladesh, Cameroon, Chad, Egypt, Gambia, Ethiopia, Guinea, Ghana, Iran, Iraq, Jamaica, Kenya, Liberia, Kenya, Malawi, Malaysia, Morocco, Namibia, Nigeria, Qatar, UAE, Zimbabwe and many odas.
Wit di new sanction, World Bank don join US and oda bodi wey dey against Uganda anti-LGBT law.