Wetin to know about Nintendo Switch 2 game

Wia dis foto come from, Nintendo
- Author, Tom Gerken & Tom Richardson
- Role, Technology reporter & BBC Newsbeat
- Read am in 5 mins
Nintendo don reveal Switch 2, dem go release di long awaited successor to one of di best-selling consoles in history, on 5 June.
Na since January wey fans don dey wait to find out more, wen di Japanese gaming giant bin end months of speculation to comfam basic information about di new device.
For one Nintendo Direct online presentation, wey more dan one million pipo bin watch, dem give more details about di hardware, dem also confam say e go dey accompanied by Mario Kart World, na new edition of Nintendo most famous game.
Dem also announce a series of oda new titles for di console, including Elden Ring and Street Fighter 6.
Di company say di new device graphics and audio go better pass di previous one, and one chat button go allow players to speak to each oda while dem dey play.
Di price go vary for different markets but for UK dem go sell for £395, or £429 wit Mario Kart.
Nintendo president Shuntaro Furukawa call di new console "a leap forward", eight years afta di release of di original Switch.
Mario Kart, Donkey Kong and Kirby return
As well as di big interest for di device itself, fans bin dey interested to find out di kain games dem go fit play wit am.
Di one wey dey tortori pipo na Mario Kart World - na di game wey di franchise appear to touch well- well.
Water graphics, character tweaks, big sprawling race tracks na im pipo see from distance plus different weather and climates - Nintendo show fans say dis console get more for dis one pass di former one.
Di firm also showcase di platforming adventure Donkey Kong Bananza and Kirby Air Riders, na sequel to dia fan favourite game wey dem bin release for 2005 - both of dem dey come later dis year.
Nintendo also confam say di "compatible" Switch games go work on di Switch 2. Odas go get Switch 2 editions, e mean say dem go don update graphics and gameplay.
For Nintendo Store website, di digital versions of Mario Kart World and Donkey Kong Bananza dey go for £66.99 and £58.99 respectively.
Di physical versions both dey £8 more expensive.

Wia dis foto come from, Nintendo
Di Duskbloods and di oda games dem announce
Di games wey third party developers make – like di Elden Ring – dey noticeable too because some na di kind of high-profile games wey typically neva come to Nintendo consoles in recent years.
Dem include:
- Cyberpunk 2077
- Final Fantasy VII Remake Intergrade
- Hitman World of Assassination
- Hades 2
- Hollow Knight: Silksong
Elden Ring developer FromSoftware also reveal one new multiplayer game - Di Duskbloods - na Switch 2 exclusive, e go come for 2026.
Mouse, camera and chat function
Di console itself get a bigger screen pass di former one at 7.9 inches, wit better display - 1080p compared to di Switch 720p, wit HDR support and e dey show up to 120fps.
Marginal changes - like di larger buttons and control sticks - go get attention. But di more interesting tin na say both controls dem fit use am as mouse, as wit PC, for supported games.
Nintendo argue say dia 3D audio tech go create a surround sound experience, but dis feature no convince pipo to up di device.
256GB of internal storage na big upgrade, as Nintendo historically dey stingy for dis side.
Di C button for di switch controller na new bit of hardware for Switch 2.
E dey help to control a voice chat feature wey dey built inside di system.
Players dey pop up for di bottom of di screen, dem dey appear almost like Zoom or Teams - complete wit a low frame rate screen share - Nintendo claim say dia technology go isolate your voice regardless of background noise.

Wia dis foto come from, Nintendo
Tough act to follow
Di original Nintendo Switch na one of di best-selling consoles of all time, e don shift more dan 150 million units since dia 2017 release.
Only Sony PS2 and Nintendo own DS don prove to dey more popular.
Dia hybrid format - dey allow players to use am as a handheld device or hook am up to a TV for a more traditional home console set-up - many feel say na one of di big reasons behind dia success.
Even if di new device go replicate dat level of interest, e go need to overcome oda challenges.
Console launches most times dey hit with hardware shortages - na trend wey bin dey particularly evident wen PlayStation 5 and Xbox Series consoles bin launch for late 2020 during di Covid-19 pandemic.
Nintendo President Shuntaro Furukawa bin previously tell investors say part of di reason for di long wait for di new console na to ensure say di company fit manufacture enough machines to meet di demand.
Since den, di global trading picture bin dey affected by President Donald Trump wave of tariffs - e no dey clear yet how e go fit affect di production and sales of Switch 2.






