Apple say e dey wrong to dry your iPhone inside bag of rice

Phone for isnde rice

Wia dis foto come from, Getty Images

Apple don draw ear warn pipo say make dem no try to dey dry iPhone wey don wet inside bag of rice.

Even though e don be very popular practice, sabi pipo don dey warn since against, even add test join to show say e no dey work.

And now Apple demselves don drop update about wetin go happun if you carry your iPhone put inside bag of rice.

Dem say wetin go happun be say small particles from di rice go enta your phone and spoil am from inside.

Apple advise say, instead of rice, wetin pipo suppose do na to gently tap out di water as di phone connector dey face ground, before you leave am make e dry finish.

Even though smartphones don dey sophisticated ova di years, but di way dem dey take fix am if e drop inside water don dey as e dey, wit almost no improvement.

Apple don use dis time take drive oda tins wey pipo wey dey use fix dia wet phones wey dem suppose to stop dey do.

  • Dem advise pipo not to use extra heat like di ones wey dey hairdryers to take dry di phone.
  • Dem also advise make pipo no chook tins like cotton swap or paper towel inside dia phone.

Howeva, Macworld wey be di first to sight di new update for support tok say with di wat smartphones design dey change like dis, all dis advise fit no dey necessary for future.

Dis na sake of say newer versions of phones get odeshi to wetness.

All Apple products from di iPhone 12 and afta fit sink enta water of up to six metres and for up to 30 minutes.

But wit di way cost of living wahala don dey grow di market for second hand phones, e be like dis kain advice go still dey necessary for some time.

Oda tins wey phone manufacturers no wan make dia users use phones do

1. Apple no want make you use battery wey don spoil

Apple warn make pipo no dey use phone if di battery or di iPhone don spoil on top say, e fit cause overheating, fire or injury.

Di damage fit happun if di phone or battery fall for ground, burn, puncture, crush or if e near liquid.

Dem say na only trained technician suppose dey solve battery wahala so as to prevent am to damage.

2. Samsung no want make you let your battery low pass 50%

Di explanation na say most smartphones get lithium-ion battery wey dey live longer if you charge am regularly.

So why 50%? So di prevailing wisdom be say if you allow your phone to kontinu to die finish bifore you charge am, e fit shorten di life of di battery.

Howeva if you still leave your phone to dey charge afta e don full, e fit still shorten battery life.

3. No dey refuse to update your software

How many times you don postpone update software wen you get update.

Yes e dey take time but if you no dey so am regularly e fit cause your hone to hang.

Samsung say if you update di software to di latest version, e fit help to improve di way your phone dey wroj with bug fixes and security patches.

4. iPhone no go really work for place wey dey very hot

Phone with weather

Wia dis foto come from, Getty Images

Shey you sabi say iPhone get temperature wey you fit use am?

Di way dem build iPhone na to work for temperatures wey dey between 32° and 95° F (0° and 35° C).

E also get temperature wey you suppose keep am if you no dey use am. Dat na between -4° and 113° F (-20° and 45° C).

Wetin fit happun if e pass dat temperature be sat e fit spoil and di battery life fit short. But normally if di phone dey overheat, e dey normally stop to work, so e go see wia to cool down.

Apart from dat sha, e dey normal if your iPhone dey warm wen you dey charge am.

5. Apple no want make you use charger wey don break

Dem advise say wen pesin dey use devices no dey bend am on angle so e no go break.

Di advise na to dey regular check di cable and connector weda e get any bed, breaks or damages, and if you find am, stop to dey use am.