Features of iPhone 15, how EU law force Apple to introduce type C charging port

Person holds an iPhone 14

Wia dis foto come from, Reuters

Apple don confamm say dia new iPhone no go feature dia exclusive lightning charging port, afta EU force di change.

Di tech giant tok say di iPhone 15 wey dem unveil for dia annual event on Tuesday go use USB-C cable as di "universally accepted standard".

Dem also unveil a new Apple Watch series wit a more advanced chip.

But one analyst tok say lack of "headline-grabbing" updates from Apple dis year go disappoint some pipo.

“No be surprise sake of di maturity of di iPhone and Watch,” Ben Wood from CSS Insight tok.

“E reflect just how refined di iPhone and Watch device dey and how tough e don become to deliver truly disruptive updates evri year.”

Apple release a USB-C-to-lightning port adapter for £29 ($36). Di product connect di lightning port accessories pipo go don build up ova di years to di new USB-C-enabled iPhones or iPads.

New iPhone 15 carry type C charger
Wetin we call dis foto, New iPhone 15 carry type C charger

Di company tok say di USB-C cable wey don already dey work wit Apple laptops and iPads go also work on new versions of dia AirPods Pro earphones and wired Earpods headphones.

Di EU bin tell di tech giant to leave dia proprietary charging ports to make life easier for consumers, save dem moni and help reduce e-waste by encouraging di re-use of chargers.

However, some pipo warn say di move go lead to rise in discarded cables in di coming years.

Perhaps in response, Apple bin use dia launch event on Tuesday to make a series of environmental pledges about dia new devices, including making di new Apple Watch range carbon neutral for di first time.

E go also increase di amount of recycled materials wey dem dey use for batteries and oda parts of di new Watch and iPhone.

Di company also confirm say dem no go use leather again for any of dia accessories and dem pledge to become carbon neutral as a business by 2030.

Apple oga Tim Cook tok say di new iPhone 15 range include di “best and most capable iPhones wey we don eva make”.

Apple iPhone 15 features

  • Di iPhone 15 Plus don give brighter screens and improved camera systems, while di high-end iPhone 15 Pro and Pro Max now come wit titanium frame, wey dem do do improve im strength.
  • Di Pro and Max also get "action button" in place of di mute switch wey fit dey customised for a variety of functions.
  • Di new Apple Watch go feature gesture control - double tapping two fingers togeda for di same hand wey wear di device enable di wearers to answer or end a call.

But some experts question whether consumers go dey prepared to pay di high price tags for di devices sake of say dem no too dey different from old ones.

How much be di new iPhone?

Di iPhone 15 go start at £799 and di iPhone 15 Pro go start at £999 for di UK.

"Convincing users to buy dis new devices no go dey easy during a cost-of-living crisis," Paolo Pescatore tok. Na analyst and founder of PP Foresight. "Some pipo go see di new features as incremental, [although] collectively dem enhance di overall experience wey dey priceless among Apple's core user base."

Apple shares bin go down slightly on Tuesday, and di firm fail to reverse one sharp drop wey happun last sake of say reports tok say di Chines goment don ban officials from using iPhones.

Huawei's release of one new smartphone series for China cause investor to panic.

Di global smartphone market don slump from shipping 294.5 million total phones to 268 million for di second quarter of 2023.

But Apple shipments fall no too fall compared to major smartphone makers. Apple shipments drop from 46.5 million phones to 45.3 million, according to analysts Counterpoint Research.