You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Life and times of Kenyan actress Winnie Ndubi Bwirea wey die of cancer
Fans and friends don send dia prayers and condolence messages to di family of late Kenya actress, Winnie Ndubi Bwire wey pass away afta battling cancer for two years.
Ndubi wey dey popular for her role as Dida in Sultana TV show die on Thursday, 5 September at di age of 44.
Di actress family announce her death on Thursday morning, after she die for Turkey hospital wia she dey undergo treatment.
"Na wit heavy heart and humble acceptance of God we announce Winfred Bwire Ndubi say she lose her battle to cancer on 5 September, 2024 while undergoing treatment for Turkey," di family statement tok.
Di family appreciate pipo for dia donation and support during di cancer treatment for di deceased.
"We thank you all for your great support, prayers and generous giving during her treatment. We go share more details in due course."
Recently she bin request for financial assistance to help wit her cancer treatment for Turkey.
Ndubi beg for Sh7 million aid to cover di costs of her treatment, and living expenses for Turkey
For di her last video she do bifor her death, she bin tell her fans about her medical progress and why she go need to go back to Turkey for treatment
"If you fit support me, I no get anytin to give in return, but you go save my life. I bin no want make dis video dey emotional; I want am to dey filled wit hope," she tok for di video.
"Right now, I dey frustrated by how expensive healthcare dey. Every time I feel like I don go ten step forward, E be like I dey drag backwards eight times."
Her colleagues for industry ontop social media help call out for help from di public to fund Ndubi treatment for Turkey.
Tributes don dey pour in for di late actress. Many of her colleagues and fans dey mourn her death on social media. Dem describe her as strong pesin wey fight till di end.
Who be Winnie Ndubi Bwirea
Winnie Bwire na Kenyan actress wey don dey act since age six but she no dey famous until her role as 'Dida' for di TV drama series 'Sultana.'
Bwire bin dey in romatic relationship wit Dan Sonko but dem end am for 2023.
She don appear in oda productions like 'Kisasa' and 'Tehanini' on Maisha Magic East.
She also don act for 'Kalimani Dynasty' on KTN and 'Penzi' on Raia TV.
She begin fight breast cancer for 2022, afta her doctor reveal to her say na stage four breast cancer be her diseases.
Di multi-talented actress na scriptwriter, songwriter, singer, painter, and interior designer, baker and enterpreneur.
She get Bsc degree in Industrial Fine Art and Design from Makerere University.