You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
How much be America president salary?
For your mind, how much you tink say United States president dey collect?
You must tink say as par di number one citizen for US and one of di most powerful position on earth, say im dey make millions.
But dis no be di case. US presidents na public servants and so, as na tax payers dey pay dem di for dia work, dem must to give dem value for dia money.
Former President Joe Biden bin dey make $400,000 a year and dis no go come as surprise for President Donald Trump as e don enta office.
Dis na becos di president salary never change since before di 21st century.
Throughout im four year term wey bin start for 2016, Trump no gree collect di salary, instead im bin direct am to different agency each quarter.
For fourth-quarter 2019 im bin donate im salary to di Department of Health and Human Services to "support di efforts wey dem bin dey make to confront, contain, and combat Coronavirus," one White House press secretary tok dat time.
Worth about $3 billion, Trump na di wealthiest person to ever occupy di Oval Office, according to Forbes.
Breakdown of US president salary and allowance
- United States president salary - $400,000
- Oda allowance include $50,000 per year for expenses like cloth
- $19,000 for entertainment
- $100,000 to take repair di White House wen im move inside for di first time.
- In addition to di house, im also get workers wey dey run am like cook, gardeners and maids dem.
- Also, di president get free health care, free travel for presidential limo, Marine helicopter and Air Force One.
- E also get non-taxable $100,000 travel expenses per year.
Adjustment of United States president salary
Since 1789, wen George Washington become di kontri first president, na only five times dem don adjust di president salary for United States.
At first, na $25,000 dem bin dey collect. According to modern standards dat amount worth about $895,700 today, according to one inflation calculator.
Di reason behind presidential salary na to make sure say presidents no go put hand for corruption.
Di last time wey dem increase presidential salary na for 2001 wen Congress double am from $200,000 to $400,000.
- 1789: $25,000
- 1873: $50,000
- 1909: $75,000
- 1949: $100,000
- 1969: $200,000
- 2001: $400,000
President no follow for top 1%
If we just look at wetin di US president dey collect as salary, den di position way, far from becoming America top 1% wey dey collect $788,000 per year.
Still di salary for dis position dey six times higher dan di average American salary of $63,795 a year.
Wen president leave office, goment go continue to pay am till im die.
In go still dey collect about $244,000 a year, plus security, health care coverage and paid official travel.