Who be Islamic singer Rukayat Gawat wey die

Read am in 2 mins

Early Tuesday morning, Nigerians bin wake up to hear about di death of popular Islamic singer Rukayat Gawat-Oyefeso.

She dey popular for her style of Islamic music and captivating voice wey many Muslim pipo dey like to listen to.

Na one popular cleric Alfa Aribidesi At-Tawdeeh Islamic Da’awah wey base for Ilorin, Kwara State, North-Central Nigeria, bin break di tori for im social media page.

Broda to Late Ms Rukayat Jubril Gawat bin also confam di death for social media X wia e bin post one Quranic verse wey tok about death.

Im post bin read, “Indeed we belong to Allah, and indeed to am we go return.” Q 2 V 156

Although e never dey clear wetin cause her death but family and friends don gather to pray for di late Rukayat according to Islamic rites.

Di bodi don dey moved to Ijebu Ayepe, Ogun State, Southwest Nigeria immediately afta di Janaza prayer for final burial.

Tins to sabi about late Rukayat Gawat

Late Rukyat Gawat-Oyefeso na pikin of one popular broadcaster Alhaji Rasaq Aremu Gawat wey go missing years ago. Di whereabout of Aremu Gawat never dey known till date.

Di late singer bin dey married to Shakiru Oyefeso.

For 2016, Late Rukayat Gawat Oyefeso bin gbab Best Female Islamic Musician title for one City People Entertainment award event.

Late Rukayat Gawat Oyefeso bin tok for one interview wit tori pipo Punch for 2017, say her missing papa dey motivate her.

She bin tok about how her papa popularity don create opportunity for her family.

Late Rukayat Gawat na sister to Jubril Gawat, Senior Special Assistant to di Lagos state Govnor Babajide Sanwo-Olu on New Media.