Hilda Baci complete challenge to make world biggest pot of jollof rice

Hilda Baci and team dey cook big pot of jollof rice
Read am in 4 mins

Thousands of Nigerians on Friday 12 September gada for Eko Hotel and Suites for Lagos, southwest Nigeria, to watch as former Guinness World Record holder and food influencer Hilda Baci, cook di biggest eva pot of jollof rice in di world.

Jollof rice na food wey dey popular for Nigeria, Ghana, Senegal, Sierra Leone, Liberia, among odas.

Di 28-year-old wey gain global recognition for 2023 for breaking Guinness World Record for di longest cooking marathon, (individual), wit a time of 93 hours 11 minutes tell BBC News Pidgin say di reason why she attempt to make di record na bicos Naija no dey carry last.

"Na we be di giant of Africa, and jollof na food wey evribodi sabi Africans for. I kon tink am say as di giant of Africa and say our jollof mad, e go make sense if we get di biggest pot of jollof rice, e go dey nice for we kontri."

Dis na di first time pesin go try to cook di largest ever pot of jollof.

As hashtag #HildaBaci and #GuinessWorldRecord dey trend for social media, crowds, especially di Gen Zs, millennials, food lovers, vendors and celebrities gada for di venue to show dia support for Hilda Baci.

Pipo sit on di floor
Wetin we call dis foto, Some pipo stand, oda pipo sidon for floor to watch Nigerian chef Hilda Baci cook di biggest pot of jollof

'How to make di biggest pot of jollof rice'

Chefs wey wear red and yellow overall gada for di front of one veri big pot
Wetin we call dis foto, Di giant custom-made pot get capacity of 22,619 litres

Hilda Baci tell BBC News Pidgin say e take about one year to come up wit ideas and plan how di cooking go take waka.

She say to produce di pot alone take two months.

"E take us two months to make di pot wey we go use cook di biggest pot of jollof for di world and na locally made."

She reveal say di giant custom-made pot get capacity of 22,619 litres. Hilda Baci add say plenty pipo come togeda to create dis magic. "Di culinary team pass 300."

Hilda Baci give estimate of di ingredients she bin use cook di jollof rice as:

  • 4,000 kg of rice - 200 bags of rice
  • Ova 1200kg of tomato paste – 500 cartons of tomato pastes
  • Lots of seasoning cubes
  • 600kg of onions
  • 6000kg of water
  • 168kg of goat meat
  • 700kg of oil
Nigerian chef Hilda Baci wear apron dey cook for kitchen during di cook-a-thon for 2023 as she dey attempt to break Guinness World Record

For 2023, Guiness World Record crown di Nigerian chef Hilda Baci as she break di record for di longest longest cooking marathon, (individual), wit a time of 93 hours 11 minutes.

She become national sensation afta she cook for four days. Her attempt bin captivate di kontri as politicians and celebrities stop to hail her.

"Hilda cook-a-thon in fact dey so popular so tey our website crash for two days sake of di heavy traffic we receive from her legion of loyal fans," GWR bin tok.

Hilda bin cook for 100 hours - and she dey allowed five-minute break each hour or di equivalent ova several hours. However, GWR bin log her record at 93 hours 11 minutes, sake of say she take longer break pass di one dem allow for one one occasion.

She still beat di previous record by more dan five hours wey one Indian chef Lata Tondon set for 2019.

Afta her marathon cooking session, she tok about wetin motivate her: "I just reason say I gatz do sometin… out of di ordinary to put myself on di map, to put Nigeria on di map, to put young African women on di map."

"I also decide to break dis record to truly push my limits and test my abilities," she add.

Afta she graduate from Madonna University, Nigeria, wit degree in sociology, Baci bin decide to start her culinary career. She dey inspired by her mother, Lynda Ndukwe, wey also be chef.

Baci bin host one television show Dine on a Budget for 2020. She win di Jollof Face-off competition for 2021. Representing her native Nigeria, Baci beat Ghana Leslie Kumordzie to claim di victory.