How 'very demure' become viral expression for social media

Read am in 3 mins

One phrase dey always take ova di internet. Bifor na "delulu" now e don turn "very demure".

E dey evri wia sotay Jenna Ortega from Wednesday, Lily Collins from Emily in Paris and even Jennifer Lopez don rush to do videos about am.

Di phrase "very demure" start to dey very popular afta one content creator for TikTok, Jools Lebron post one video on 5 August about how she dey approach her work and her make-up.

Di video bin start for inside her motor as she tok say, "You see how I dey do my make up for work? Very demure, very mindful."

Na so dat video don gada ova 30 million views and she now get ova 1.5 million followers for TikTok.

Since dat time, e don blow up worldwide wit ova 200,000 posts wia dem don use di hashtag and oda videos wey dey tok about how to act "very demure" for oda situations.

Meanwhile, 'demure' na word wey dey describe woman wey dey quiet, reserved and modest.

For dis trending video, Jools dey try explain how she dey do her make-up wey no too dey colourful.

E be like say even brands don carry di word for head sef.

So far Jools don begin dey get endorsement from car riding app and cosmetics brands wey don enta her comment section.

Bifor she blow wit dis content, Jools bin get growing popularity for TikTok for her GRWM content as well as review for products.

When she bin dem ask am wia she get di idea for di content from, Jools respond say "well apparently, di trauma wey you go face wen you dey do retail job fit plenti sotay you go start to dey tok demure for di internet".

She add say, "I feel like demure na mindset. I bin dey craze and dey out of control, and den I find some demurity and wit dat come success."

Di Oxford dictionary define demure as "to dey reserved, modest and shy".

Dis na just one of plenti phrases wey don enta daily trends for social media.

Similar type of trend

Trends dey come from anywia for social media, from music to old TV shows wey dey get dia shining era again.

Like di "brat summer" wey US Vice President Kamala Harris take showcase herself give young voters as di nominee for di Democrats, na from one musician wey dem dey call Charli XCX dem get am from.

Even trends don comot from Nigeria and Africa wey turn to slang across di rest of di world.

Di song by Nigerian musician Ckay wey im call Love Nwantiti blow ova di world during di coronavirus pandemic sake of social media.

Na also how pipo start to tok about Kenergy afta di release of di Barbie movie for 2023.

But some dey comot from normal TikTokers, like di pesin wey start di TikTok trend wey dem dey call 'NPC' live stream.

Dis trend start for 2023, wen one content creator wey dem dey call PinkyDoll comot for livestream dey behave like pesin wey dey inside video game.

PinkyDoll wey her real name na Fedha Sinon, bin dey do live streams wey she go respond in a specific manner depending on di gift wey dem give her for her TikTok streams.