Voting close, counting start for Cameroon presidential election

Vote counting dey go on for Cameroon afta polls close for di presidential election.
Citizens wey dey home and abroad cast dia vote and ballots for di ten candidates wey dey contest for di election.
Some observers say voting bin dey largely peaceful, even though small small kasala happun for some polling stations.
For one location for di capital Yaoundé, di BBC bin meet crowd of voters wey dey para, wey insist say dem must protect dia votes.
Dia reaction come afta one order wey one electoral official give say make dem comot from di entrance of di voting hall.
Voter turnout for some polling stations dey low.
Meanwhile, for di Anglophone regions wey small kasala dey happun wia separatists bin bar residents from voting, some pipo bin come out to vote for dia next leader.
Many oda stay away sake of say dem dey fear if jaguda pipo go attack dem.
Shortly afta voting, President Paul Biya praise di maturity of how dem conduct di polls, e describe process as calm.
Opposition candidate and former Biya ally Issa Tchiroma Bakary wey vote for im hometown of Garoua, say pipo bin threaten am well-well today as im bi di subject of threats.
"No be Tchiroma be di problem, im tell reporters, as im add say im "put imsef under di protection of God and di Cameroonian pipo."
"I dey for my house; I no go move. If dem plan to come carry me comot from my house, I no go move," im bin declare.
For di campaign trail, Tchiroma bin gada massive crowd, and analysts position am as di leading challenger to 92-year-old Biya.
Ahead of di election Interior Minister Paul Atanga Nji bin warn candidates against declaring victory by demsefs, im add say only di Constitutional Council dey allowed to release official results.
Im bin allege say e receive information say one candidate wey dem no mention im name dey plan to claim victory beforehand.
Nji bin also dismiss private initiatives to collate votes afta di polls, as e threaten arrests and legal action against defaulters.
Di Constitutional Council get 15 days from di day of voting to announce results.












