Court don release Dani Alves on €1m bail afta dem find am guilty of raping woman inside toilet - Wetin happun so far

One court for Spain don rule say make dem release former Barcelona and Brazilian footballer Dani Alves on bail afta im don serve small part of im rape sentence.

For February, one court for Spain bin find Dani Alves guilty of raping one woman inside one Barcelona nightclub and dem sentence am to four and a half years in prison.

Di court release am on €1m (£853,000) bail.

Part of di conditions for im release include say make im submit im Brazilian and Spanish passports so im no go fit run comot for Spain.

Im must also kontinu to dey appear for di court evri week and di court say make e no go close to di victim.

Dani Alves lawyer say di footballer don already serve about quarter of im prison sentence afta im arrest.

Di court bin find say Dani Alves and im friend buy champagne for three young women bifor im kon lure one of dem go VIP area of di club wit toilet.

How dem sentence Dani Alves to prison ova rape allegation

One court for Spain bin find former Barcelona and Brazil footballer Dani Alves guilty of raping one woman inside one Barcelona nightclub.

Dem sentence am to four and a half years in prison.

Di 40-year-old, wey be one of di most decorated footballers in history, bin deny say e sexually assault di woman for di early hours of 31 December 2022.

Im lawyer bin ask say make dem free am and Alves fit appeal against di sentence.

Alves bin dey face accuse say e deceive di woman go toilet for one VIP section of di nightclub and bin argue say she for fit leave "if she bin want to". However, di court find say she no give consent.

Inside statement, di court say evidence dey oda dan di victim testimony wey prove say dem rape her.

Dem also order am to pay €150,000 (£128,500) to di victim.

Alves don dey pre-trial detention since January 2023 and during dis month trial e don change im testimony on different occasions.

E first deny say e know di accuser only to later claim say e bin meet her inside di toilet but say notin bin happun between dem.

E come change im tori again, say dem do consensual sex. "Both of us bin dey enjoy ourselves," e allege.

Prosecutors say Alves and im friend bin buy champagne for three young women before dem ask one of dem to follow am to anoda area wey get toilet wey she no know.

At dat point dem argue say e turn violent, forcing di woman to have sex wit am despite say she request again and again to leave.

Alves play more dan 400 times for Barcelona, winning six league titles and three Champions Leagues across two spells wit di club. E also be part of Brazil 2022 World Cup squad.

Di prosecution bin ask for a nine-year prison sentence. For Spain, dem dey investigate a claim of rape under di general accusation of sexual assault, and if dem find pesin guilty, e fit lead to prison sentences of four to 15 years.

Dem change di law recently to include di importance of consent under di so-called "Only Yes is Yes" principle.