How viral prank video land popular skit maker Trinity guy for trouble

Trinity guy

Wia dis foto come from, Trinity Guy/Instagram

One Family Court wey siddon for Iyaganku area of Ibadan, Oyo state capital don order make dem remand popular skit maker, Maruf Abdullahi, popularly known as “Trinity Guy”, for Agodi correctional facility over alleged sexual exploitation of one 10-year-old girl.

Na di state police command carry am plus di papa and mama of di young girl go court, on two count-charge of conspiracy and sexual abuse and exploitation.

One viral video of Trinity Guy bin spark outrage for social media as plenti pipo bin dey ask for im arrest.

Inside di video, di skit maker dey ask di young girl weda she see im genital and wetin di color be.

Di Magistrate, P.O Adetuyibi wey no gree take di plea of di defendants for want of jurisdiction, say dem don file case and even duplicate for di Oyo State Ministry of Justice.

Adetuyibi remand di three defendants for Agodi correctional facility, Ibadan, pending 11 July wen dem go bring di case up for mention.

Di case against Trinity guy

Di case wey dey against Trinity guy and im co defendant na sexual abuse and exploitation of small pikin.

Prosecution Counsel, Inspector Oluwakemi Arowosaye, bin tell court how “Trinity Guy”, for 17 December 2022, bin sexually abuse and exploit one girl for Kuola area of Ibadan.

Arowosaye say di victim parents and and Trinity guy bin plan to sexually abuse di girl.

“Abdullahi bin ask di victim di colour of im penis, and dey record di scene and post am for social media,” she tok.

Offences wey di counsel explain say dey against Nigerian law.

Police for Oyo state also tok say wetin Trinity guy do dey against di law.

Di South-west state police bin confam say skit maker, ‘Trinity guy’ and di parents of di young girl wey dey for di video wey cause gbege don dey remanded for prison.

“Creative content creator and skit maker, Abdullahi Maruf Adisa 'aka' Trinity Guy' 'm'. 31yrs and both parents of di minor for di sexually explicit viral skit recording don dey remanded,” Oyo state police tok for social media.

Dem say di act dey against Section 516 of di Criminal Code of Nigeria.

E also dey against Section 35 (1) of di Oyo State Child Rights Laws 2006 wey dey punishable under subsection (2) of di same law.

How 'Trinity guy' land for trouble

screengrab

Wia dis foto come from, SCREENGRAB/TWITTER

Na di Nigeria Police PRO, CSP Olumuywa Adejobi bin first table di mata on Monday 19 June on top im viral prank video wia im pretend say pesin shoot am.

But na on Thursday 22 June e call for di comedian arrest ova di girl child viral video.

Di video wey Trinity Guy don remove from im page bin show as im dey threaten to beat one small pikin wit im shoe until she tell am weda she see di colour of im genital as im dey use di bathroom.

Di video show as di girl dey fear and shake dey try negotiate wit di man so she no go chop beating.

Na one social media user tag di force toktok pesin, wit many odas wey also call for im arrest.

Oga Adejobi call di video "rubbish and criminal" as e hala say "I hate dis scene! Child Abuse."

Trinity Guy controversial skits

One pesin kneel down as odas dey waka pass

Wia dis foto come from, Trinityguy/tiktok

No be today Trinity Guy dey enta controversy wit im prank videos.

Di social media star wit ova 60 thousand followers for Instagram don enta trouble bifor as one of im more popular pranks na to comot women wig run.

Infact for one of im videos, e look like say im carry imself on top okada pour one woman water.

For di video wey first catch police attention, e bin dey act like say pesin kill am sake of say im owe money.

Sotay e pursue one woman enta uncompleted building hold her dia for a long duration of di video as e dey tell am say "dem wan kill me" and "dem get gun for hand".

Di woman hit am plate for im head bifor e allow am comot to escape.

Currently, Nigeria no get Law wey dey regulate social media.

E bin get one anti-social Media Bill wey one Senator introduce for 2019 to criminalise di use of social media for pipo wey dey use am do bad tin.

Plenty pipo oppose di bill dat time. Till now, nothin don happun on top di bill.

Also, di National Information Technology Development Agency (NITDA) announce last year say dem don develop one draft Code of Practice for Interactive Computer Service Platforms/Internet Intermediaries.

Di draft na part of wetin di former administration bin wan do to regulate social media.

Who be Trinity Guy?

Trinity Guy

Wia dis foto come from, INSTAGRAM/TRINITYGUYZ

Abdullahi Maruf na one of triplets.

Bifo e start to dey make skit for social media, im bin first try im hands for music, wit im triplet brodas for 2016 under di name Trinity Guyz.

Di Ibadan based content creator dey mostly use Yoruba do im skits and even feature for some feems.

E also don enta wahala bifor say e carry gun to enta di END SARS protest of 2020 wen pictures begin spread online wit am as e dey hold gun.

E later comot to clear di air say di pictures no be from di protests but na props wey im use for music video.