You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Forbes top ten list of highest paid athletes for 2023 and wetin dem earn
Di top three highest-paid athletes for di world of sports for di past 12 months na footballers, according to di 2023 list wey Forbes publish.
Cristiano Ronaldo ogbonge transfer to Saudi Arabia wit Al Nassr help am make a reported $136 million.
Out of dat $136m, $90m come from off-field income, including brand partnerships wit di likes of Binance and LiveScore.
Second and third for di list na Paris Saint-Germain forwards Lionel Messi and Kylian Mbappe.
Tori be say Messi earn about $130m - more dan $350,000 per day - ova di last year.
Im sponsors, wey include Adidas, Budweiser and PepsiCo, go happy wit Messi performance to help Argentina to glory for di 2022 Fifa World Cup for Qatar.
Messi na also ambassador for di tourist board of Saudi Arabia.
Mbappe, wey win di Golden Boot for di World Cup wia im lose di final wit France, bin make $120m in di last 12 months.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di 24-year-old bin make more dan Messi and Ronaldo in terms of im on-field earnings, wen im receive big bonus for extending im contract wit PSG afta heavy interest from Real Madrid.