Why di price of cooking gas dey go up for Nigeria

Wia dis foto come from, Tolu Owoeye/Getty Images
- Author, Andrew Gift
- Role, BBC News Pidgin
- Author, Adesola Ikulajolu
- Read am in 4 mins
Di price of cooking gas don go up from N1,200 to N2,500 Naira for some parts of Lagos state and some oda parts of Nigeria.
Some gas depots for di West African kontri dey sell at N2,000 naira per litre, while some dey sell for N2,200 naira
For some parts of Abuja, di kontri capital, di price of gas climb from N1000 naira to N1800 naira. While some dey sell at N1700 naira.
For Ogun state, south-west Nigeria, one litre of cooking gas dey go for 2,200 naira
For plenti locations for Lagos wey BBC News Pidgin monitor, di product dey scarce as some vendors dey hoard di product.
Mr Chika Umodu wey be dealer tell BBC News Pidgin say im get gas, but say e no fit reach all customers wey want am, na im make am dey allocate di amount one pesin fit buy.
"If you need like 10kg, we go give you 4kg, so e go fit go round, and I get plenti customers wey I bin dey serve, so I get to consider dem too" e tok.

Wia dis foto come from, Getty Images
Anoda dealer wey no want make we mention im name tok say for di past five days, im no get gas. E say di one im get now just arrive today and dat na why plenti pipo rush come im shop to buy gas.
E say na di strike by oil workers cause am.
Price of CNG gas wey dem dey use for car also climb from 230 to 380 per litre.
E never too clear wetin cause di scarcity and price hike, but plenti pipo dey attribute am to di strike wey oil workers do last week wey make dem stop work for some days.

Wia dis foto come from, Gift Andrew/BBC
'Gas price increase dey artificial'
Di Group CEO of NNPCL, Mr. Bayo Ojulari, tell tori pipo during im briefing to President Bola Tinubu say di increase for gas price na sake of di strike wey di Petroleum and Natural Gas Senior Staff Association of Nigeria (Pengassan) do.
Although, Ojulari visit na to give progress report especially on top production performance for di oil sector wey e dey handle, e also comment on di price of gas for Nigeria.
"Di increase for gas price dey relatively artificial, becos of di period of di strike, wetin e mean be say, gas loading bin delay by two to three days."
"Becos of dat, you see dat impact and as time dey go, e go take time bifor distribution dey fully restored."
NNPC CEO say na pipo wey get di product bin hold am and increase di price becos distribution no dey during di time wey Pengassan bin dey on strike.
E dey hope say di price of gas for Nigeria go go back to di normal price wey e dey bifor di strike.
"Sake of dat delay, some pipo wey get existing resources and reserves put up di price. My expectations na since tins don go back to normal, prices go return to normal."










