Gunmen attack church for Anambra, how e take happun?

Armed guy

Wia dis foto come from, LIONEL HEALING/AFP via Getty Images

Read am in 3 mins

Some armed men attack a church for Ihiala local govment area of Anambra state wia dem cause injury to pipo.

Di attack wey happun for Sunday 7 December, 2025 occur for Lilu community area of di local govment.

According to Anambra police command, na armed criminals come attack di church causing serious injury and also burning part of di church building.

Dem say one pesin die from di attack while odas wunjure.

"Di attack wey hapoun for morning of 7 December 2025, wey some armed criminals bin carry out result in death of one pesin wit serious injuries on few odas."

"Di church building dey partially burnt, and oda properties destroyed for di church premises," di police tok.

Di church wey pipo later identify as St. Andrews Anglican Church, even though police no name am, bin dey do dia service wen di jaguda pipo enta and scatta evritin.

Report say di jaguda pipo begin shoot as worshippers dey ready to begin Sunday service, na so fear catch plenti pipo.

Na sound of di gun make pipo begin dey run to save diasef.

Bifor di gunmen comot for di church premises, dem burn some parts of di building and destroy different parts of di church.

Di community wia dis incident happun na one of di border town wey Anambra get wit Imo state.

According to di police, di act wey di gunmen carry out on di worshippers na bad one.

Di Commissioner of Police, Anambra State Police Command, CP Ikioye Orutugu, don condemn di incident wit promise say dem go hunt down di pipo wey carry out di attack.

"Dis heinous and abominable act, committed against innocent worshippers, no be only an assault on di community but a serious gbege to our shared values of peace, sanctity of life, and freedom of worship."

Anambra police send condolence to di families of di pipo wey dey affected and say "police no go rest until dem hunt down di perpetrators of dis crime."

"Di command don alreadi intensify intelligence-driven operations, deploy di Joint Security Team, and strengthened surveillance across di area."

Dis attack for Anambra church dey come few weeks, afta bandits bin abduct 38 worshippers of Christ Apostolic Church, Eruku for Kwara state.

Later, di 38 worshippers bin regain freedom less dan one-week afta gunmen wey call themselves bandits attack dia church during one evening service on Tuesday, 18 November.

Meanwhile, Nigeria President Bola Tinubu don declare nationwide security emergency for di kontri afta weeks of kasala nationwide, for same time wey different attacks bin dey hit di kontri.

As part of di declaration, oga Tinubu order di police and army make dem employ more pipo for inside dia ranks.