You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Sean 'Diddy' Combs face new charges of sex trafficking and prostitution
- Author, Christal Hayes
- Role, BBC News, Los Angeles
- Read am in 4 mins
Dem don hit Sean "Diddy" Combs wit two new criminal charges wey include sex trafficking and engaging in prostitution.
Dis dey come just a month bifor e dey set to go on trial for New York.
Di new accusations wey dem make public for Friday in a Manhattan court bin include allegations of more recent criminal offences against anoda victim.
Prosecutors allege say Mr Combs bin recruit, transport and force dis victim to engage in sex acts and prostitution from 2021 to 2024.
Di hip-hop mogul don deny all di allegations against am, and im legal team argue say di charges na based on consensual activities "no be by force".
"Dis no be new allegations or new accusers," Mr Combs legal team tell CBS News, di BBC US partner. "Dis na di same individuals, former long-term girlfriends wey dey involved in consensual relationships.
Dis na dia private sex life wey dey based on consent and not by force.
A grand jury probe bin put Mr Combs for trouble last year on charges of conspiracy, sex trafficking, and transportation to engage for prostitution.
Dis two new charges bring di total federal charges against Diddy to five.
Di court document no provide specifics about di new offences, but prosecutors allege say na from from a grand jury investigation.
Di original charges of sex trafficking and engaging in prostitution wey dey file against Mr Combs for 2024 tie di charges to allegations from 2009 to 2018 and relate to a different victim.
A significant portion of di most hard allegations against di rapper bin dey relate to di conspiracy charge wey includes accusations of kidnapping, drugging, and forcing women into sexual activities, sometimes using firearms or threats of violence.
Di charge includes details from a raid on im Los Angeles mansion wia police find supplies wey dey intended for one secret ceremony wey dey known as "freak offs", including drugs and more dan 1,000 bottles of baby oil.
Mr Combs na one of di most successful rappers and music moguls for di US wey dey known to dey help make pipo stars.
Dem sabi am as Puffy, Puff Daddy, P Diddy, Love, or Brother Love ova di years.
E emerge for di music scene for di 1990s and quickly become a household name.
Early for im career, e help launch di careers of Mary J Blige and Christopher Wallace - aka Biggie Smalls, or di Notorious B.I.G.
Im music label Bad Boy Records soon become one of di most important labels for rap and grow to include Faith Evans, Ma$e, 112, Mariah Carey and Jennifer Lopez.
Im star power lead to several reality shows for MTV and VH1 wia e search for di next big musical talent.
Since e don dey indicted, dozens of lawsuits don accuse Mr Combs of using dat power to drug, assault, rape, intimidate and silence pipo.
Currently, e dey held for di Metropolitan Detention Center for Brooklyn, New York as im criminal trial dey scheduled to begin on 5 May.