US VP debate: All you need sabi about Vance vs Walz

Senator JD Vance and Minnesota Govnor Tim Walz

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Senator JD Vance (left) and Minnesota Govnor Tim Walz
    • Author, Rachel Looker
    • Role, BBC News, Washington
  • Read am in 5 mins

Di two US vice-presidential candidates don set to face off for di first and only time on di debate stage on Tuesday evening.

Ohio Republican Senator JD Vance, former President Donald Trump running mate, go show up against Minnesota Govnor Tim Walz, wey dey di Democratic presidential ticket alongside Vice-President Kamala Harris.

Harris choose Walz as her running mate for August afta she step up as di Democratic nominee wen President Joe Biden drop out of di race.

Trump select Vance as im pick for July.

Di running mates debate na afta di first - and likely last - televised presidential debate betwin Trump and Harris last month.

Dis na everytin you need to sabi bifor di vice-presidential debate, wey go happun one month bifor di White House election.

Wen and wia be di debate?

JD Vance (left) and Tim Walz (right) wit CBS debate moderators Norah O'Donnell (left) and Margaret Brennan in di middle
Wetin we call dis foto, Na Norah O'Donnell (left) and Margaret Brennan go moderate di CBS debate .

Di 90-minute debate go hold on Tuesday 1 October at 21:00 EDT (02:00 BST) at di CBS Broadcast Center for New York City.

Dem go air am on CBS network TV and livestreamed on platforms wia CBS News 24/7 and Paramount+ dey accessible.

Na CBS Evening News host Norah O'Donnell and Margaret Brennan, di of host di network current affairs show Face di Nation go moderate di forum.

Dem go get two breaks, each go last four minutes.

Di BBC go get team of reporters for New York and for Washington providing analysis, fact checks and reactions as part of our live coverage.

Wetin be di rules?

Di vice-presidential debate rules na di same wit di debates betwin Trump and Harris last month, wit one small difference: microphones go dey hot.

While CBS tok say e reserve di right to mute di candidates microphones, e go remain on even wen di candidate no dey tok.

Di two go stand, unlike di last three vice-presidential debates for past US election cycles, wen candidates dey siddom.

Walz go stand behind di podium on stage left - di right side on di screen. Vance go stand opposite am.

Dem no go allow Ccmpaign make dem tok to di candidates during breaks. dem no go allow di running mates make dem bring pre-written notes on stage.

Di candidates go answer di questions from moderators witin two minutes. Di oda candidate go get two minutes to respond. Each candidate go get one minute to reply opposition.

CBS tok say na Vance and Walz go fact-check each oda statements, though “di moderators go facilitate those opportunities” during rebuttal time.

Dem no go host live studio audience or say any open statements.

Candidates go receive two minutes for closing statements. Vance win di coin toss and chose to say di final word.

Republican vice presidential candidate JD Vance

Wia dis foto come from, Getty Images

How di candidates dey prepare?

Walz don dey prepare wit Transportation Secretary Pete Buttigieg wey dey standing in as Vance.

E don dey hold late-night and weekend sessions and studying videos of im rival.

Vance dey prepare wit Republican congressman Tom Emmer, wey dey represent Wal home state of Minnesota.

E dey also hold sessions wit im lawyer wife, Usha Vance, and senior Trump adviser Jason Miller.

Wetin you need look out for?

E dey likely say Vance dey target Walz - former public school teacher and football coach - Republicans tok say e heavy-hand Covid policies for Minnesota, including setting up hotline to report on pipo wey break social distancing rules.

Vance fit also criticise Walz for signing legislation last year wey allows tampon dispensers inside boys toilets for public schools.

E fit also accuse Walz of misrepresenting im military record. In August, di Minnesota govnor acknowledged say e "misspeak" wen e say in 2018 e don handled assault weapons "in war" while advocating for stricter gun laws. Walz resign from di National Guard bifor dem deploy dia unit to Iraq.

Di Minnesota govnor dey likely to attack Vance for some of im past comments, including calling some Democratic politicians "bunch of childless cat ladies wit miserable lives".

Walz fit also go afta di Ohio senator for repeatedly defending baseless stories about migrants eating household pets in Ohio town.

E fit also embarrass Vance over im leaked messages from 2020 wia e say Trump don "thoroughly failed to deliver on im economic populism".

Minnesota Gov. Tim Walz

Wia dis foto come from, Getty Images

Election banner