Pipo 'jump from roof to roof' as flood kill 148 for Nepal

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Aleks Phillips
- Role, BBC News
- Author, Sanjaya Dhakal
- Role, BBC Nepali
- Reporting from, Kathmandu
- Read am in 4 mins
Major floods and landslides for Nepal don kill at least 148 people and injure more dan 100 across Nepal.
Nepal police say more dan 50 pipo still dey miss on Sunday afta two days of serious rainfall for di Himalayan nation.
Di rain flood di calley around di capital Kathmandu. Na about 3,600 pipo dem dom rescue so far.
Pipo say dem bin "jump from one roof to anoda" to escape di rising water, wey flood thousands of homes.
Meanwhile, authorities still dey carry out rescue on helicopters and inflatable rafts.
Even though dem forecast say rain go kontinu throughout till Tuesday, signs dey show on Sunday say e don dey reduce.
Some area pipo bin fit return to dia mud-caked house on Sunday, while odas dey cut off as major roads between towns and villages still dey blocked.
But flash floods, and landslides, don cause many deaths.
At least 35 bodies na im dem bin recover from motor dem wey bin bury under landslide for Prithvi Highway, near Kathmandu, police officials tok.
Most major highways wey connect Kathmandu wit di rest of di kontri dey blocked for many different places sake of landslides.

Wia dis foto come from, Reuters

Wia dis foto come from, Reuters
Five pipo, including one pregnant woman and one four-year-old girl, died wen one house bin collapse under one landslide for Bhaktapur, wey dey east of Kathmandu, local tori pipo report.
Two bodies n aim dem bin remove from one wey bury under landslide for Dhading, west of Kathmandu. Twelve pipo, including didriver, n aim bin dey inside.
Landslide also kill six football players wey bin dey training centre wey di All Nepal Football Association dey operate for Makwanpur, south-west of di capital.
For one dramatic scene, Nakkhu River carry four pipo for di southern Kathmandu valley.
"For hours, dem bin dey beg for help," Jitendra Bhandari, one eyewitness, tell BBC. "We no fit do nothing."
Hari Om Malla tell BBC say water bin "flow" enta im truck as di rain enta anoda gear on Friday night.

Wia dis foto come from, Reuters
"We jump out, swim, and escape from am - but my purse, bag and mobile, di rier don carry all go. I no get anytin now. Na inside cold wey stay di whole night."
Anoda pesin, Bishnu Maya Shretha, say di level of flooding dis season bin dye more extreme.
"We bin runaway di last time, but notin happun. But dis time all di houses flood.
"As di water level rise, we gatz cut roof and get out. We jump from one roof to anoda and finally reach one concrete house."
Goment tok tok pesin Prithvi Subba Gurung tell goment TV station, Nepal Television Corporation, say di flooding aloso break waterpipes, and affect telephone and electricity lines.
According to state media, 10,000 police officers, as well as volunteers and members of di army, n aim dem don mobilise as part of search and rescue efforts.
Nepal goment bin delay plus cancel some air travel on Friday and Saturday.
Monsoon season dey bring flood and landslide for Nepal every year.
But scientists say, di rainfall events dey become more and more heavy due to climate change.










