Five points to help understand di protests against ICE raids wey dey hapun for US

Read am in 6 mins

Protests against immigration raids for Los Angeles, America don continue for a third day, with police wey say downtown LA now na "unlawful assembly" area.

Dis na a breakdown to help you understand wetin dey hapun.

Wetin cause di protests

Di protests begin on Friday affta tori come out say Immigration Customs Enforcement (ICE) officers dey carry out raids across di city.

BBC US partner, CBS, report say operations take place for di Westlake district as well as for Paramount, south of LA - wia di population dey more dan 82% Hispanic.

Also reports dey of one ICE raid for one Home Depot store for Paramount, wey officials later tell BBC say dey false.

Immigration raids don increase under President Donald Trump administration, wey last month ask federal agents to arrest 3,000 pipo a day.

ICE later tell CBS say dem arrest 44 unauthorised immigrants inside a single operation for one job site on Friday. Dem carry another 77 for di greater LA area on di same day.

Di immigration pipo arrest as many as 118 pipo for Los Angeles last week sake of di result of ICE operations.

After di raids, di Federal Building for downtown LA become di focus of protests after e come out say detainees allegedly dey dia.

Dem spray graffiti on di building and stone police objects, CBS reports, leading to di declaration of an unlawful assembly.

Trump deploy National Guard as protests enta second day

Protests continue enta Saturday, wey make Trump to deploy 2,000 National Guard members to di Los Angeles area - move wey California Governor Gavin Newsom and LA Mayor Karen Bass do condemn.

On Saturday, di LA County Sheriff Department say anoda protest bin happun for di city of Paramount sake of wetin be like anoda immigration raid.

Na about 400 pipo dey involved for di protests, LA County Sheriff Robert Luna, tok. Di department den declare unlawful assembly in attempt to disperse demonstrators "witout any violence".

Law enforcement officers don fire tear gas and rubber bullets give protesters wey gada for di third day of demonstrations for Los Angeles.

Di protesters gada near di location wia ICE agents bin conduct raids on Saturday, as dem shut down a major freeway.

Los Angeles Mayor Karen Bass bin tok say di kasala for di city na "chaos wey di Trump administration cause".

California Governor, Gavin Newsom say Donald Trump decision to deploy di National Guard to di protests dey "purposefully inflammatory",

Di Democrats bin also call Trump actions an "alarming abuse of power"

US President Donald Trump don warn say troops go dey "everywhere" if di protests continue, e add say "we no go let our country dey torn apart".

Trump hail National Guard 'well done'

President Donald Trump thank di National Guard "for a job well done" hours afta e announce say dem go deploy troops to di Los Angeles area.

President Trump still repeat im criticism of di state and city Democrat leaders bifor im face di protesters: "Dis Radical Left protests, by instigators and troublemakers wey dem dey pay, we NO GO TOLERATE AM."

Im add say, "from now on, WE NO GO ALLOW PIPO TO WEAR MASKS AGAIN for protests".

"Tank you to di National Guard for a job well done," im tok.

Secretary of Defence Pete Hegseth say active duty Marines also dey on "high alert".

California Govnor Gavin Newsom say di decision dey "purposefully inflammatory and e go only increase di tensions".

Kamala Harris knock Trump decision

Di actions of di Trump administration "no be about about public safety – na about stoking fear".

"Deploying di National Guard na dangerous escalation wey di aim na to provoke chaos... na part of di Trump administration cruel, calculated agenda to spread panic and division," na wetin Former Vice President Kamala Harris tok sake of di ongoing kasala wey dey happun for Los Angeles, United States.

For di statement wey Kamala Harris post on X, Harris, di former attorney general of California, add say "protest na powerful tool – essential for di fight for justice".

"I go continue to support di millions of Americans wey dey stand up to protect our most fundamental rights and freedoms," she tok.

Wetin be ICE ?

ICE na di federal agency wey dey identify pipo wey dey US illegally and dem dey also arrest and deport illegal migrants.

Donald Trump return to power for January, and im bin promise mass deportations of undocumented immigrants. Since den, arrests don increase.

Data from CBS, BBC US partner, show say ICE arrests during Trump second term don pass 100,000.

One White House press release say: "In recent days, violent mobs don attack ICE Officers and Federal Law Enforcement Agents wey dey carry out basic deportation operations for Los Angeles, California."

On Saturday, Trump "border tsar" Tom Homan, wey bin travel to LA to supervise di ICE operations, say na "zero tolerance" for any violence or damage to private property during di protests.

Some fotos from LA riot