You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Laken Riley Act: Trump don sign im administration first law
US President Donald Trump don sign di Laken Riley Act into law on Wednesday as im first legislation for dis new term.
Di Laken Riley Act na law to increase di federal goment mandate to detain immigrants wey enta di kontri illegally.
Di Laken Riley Act bin dey named afta one 22-year-old nursing student wey one undocumented Venezuelan immigrant kill last year.
E go expand the goment mandatory detention of non-citizens wey don dey convicted of, or charged with burglary, larceny, theft or shoplifting, or di pipo wey admit say dem commit di crime.
Dis dey come one week afta di US Congress pass am as bill a day afta Senate approve am.
Di bill bin flow smoothly through di house wit vote of 263 to 156 as 46 Democrats support di Republican led measure. For Senate, na 12 Democrats support di bill.
Who be Laken Riley and how di law take come about?
Di law dey named after Ms Laken Riley, one 22 years old Georgia nursing student wey one Venezuelan man bin murder for February 2024 for one wooded area of di University of Georgia campus afta she no come back from her morning run.
Di man accused of killing Riley don dey sentenced to life in prison, inside case wey become a flashpoint for di 2024 presidential election.
One judge for Georgia bin find Jose Antonio Ibarra, wey be undocumented Venezuelan immigrant, guilty of murder and oda charges related to Ms Riley death.
Prosecutors argue say Ibarra kill di student on 22 February after going "hunting for females" on di University of Georgia (UGA) campus.
Ibarra enter US illegally on 8 September 2022, according to di Immigration and Customs Enforcement (ICE). Dem later release am for further processing.
ICE bin say dem arrest Ibarra for New York City for September 2023 and dem charge am with "acting in a manner to injure a child less dan 17 and a motor vehicle license violation".
NYPD bin release am, ICE officials tok.
Republican lawmakers bin say na White House fault say Ibarra bin dey able to remain for di country despite im criminal record.
President-elect Donald Trump, often invoke Ms Riley name on im campaign trail.
Wetin di new law tok?
Di Laken Riley law go make di Department of Homeland Security to hold on to migrants if dem don charge dem wit some kain criminal offences like theft, shoplifting, burglary, assault against law enforcements or any crime wey cause death "or serious bodily injury for anoda pesin".
E dey also empower di attorney generals for states make dem fit sue di federal goment if dia residents feel like say di national immigration policies wey dey ground dey harm dem.
Di bill no come wit new funding for immigration control measures, na wetin dey cause Democrats criticism of am say e go too cost to implement.
Liberal Democrats bin dey call out di law as unfair crackdown on suspects wey neva dey found guilty of specific crime.
But odas for di party wey vote for di move say na common sense move.