You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Key appointments Ghana new president John Mahama make
Di new president of Ghana John Mahama begin make appointments into im administration even bifor im inauguration into office.
Na Tuesday 7 January 2025 dem swear President Mahama into office for one colourful ceremony wey occur for di Black Star Square for di kontri capital, Accra.
However, a day bifor di inauguration ceremony for Accra, President Mahama bin appoint pipo into different positions as im administration set to take off.
Dis na Mahama second term as president of Ghana and some of di pipo e don appoint so far na pipo wey don dey wit am bifor for im previous administration.
Mahama bin serve as president of Ghana bifor from 2012 to 2017, now elected for di second time.
E also dey noted say for di first time for di history of Ghana, di kontri get female vice president, Professor Jane Naana Opoku Agyemang wey go work wit president Mahama.
Early morning on Tuesday bifor di swearing-in of di president, di lawmakers get dia own swearing-in for Parliament House for Accra.
Alban Sumana Kingsford Bagbin bin return as di speaker of Ghana 9th Parliament to mark di beginning of di legislative session under di Fourth Republic.
Di speaker go also work wit President Mahama.
Julius Debrah appointed Chief of Staff
President John Mahama announce di appointment of Julius Debrah as di Chief of Staff for im administration.
Di president make di announcement on Monday 6 January 2025 wia e announce say di appointment go take effect from Tuesday 7 January 2025.
Debrah bin dey appointed as di Chief of Staff for 2015 wen President Mahama be president for di first time.
E don serve as minister of local goment and rural development under President Mahama.
Bifor dat time, Debrah bin serve for di position of regional minister for Eastern Region.
Im na member of di National Democratic Congress (NDC), di current ruling party for Ghana.
Wen Julius Debrah attend di inauguration ceremony of di president, e follow local media tok how happy e dey to work wit di Mahama administration.
Debrah believe say President Mahama bin appoint pipo wey fit do di work and understand am better.
"Di president believe say I fit do di work, no be reward, e dey find pipo wey fit work and wey understand am.
"If pesin dey wey fit guess di president, na me. E dey also reward loyalty, maybe na wetin e do be dat. Mahama no dey make appointment sake of loyalty, e want pipo wey fit work."
Debrah add say e wan give evribodi hope and e dey possible if di right pipo dey in charge as Mahama administration dey kick-off.
Julius Debrah go now serve as di current Chief of Staff to Ghana president John Mahama.
Callistus Mahama appointed as Executive Secretary
Dr Callistus Mahama dey appointed as Executive Secretary to President Mahama.
Di appointment of Dr Mahama take effect from Tuesday 7 January, wey be same day dem swear-in President Mahama.
E bin graduate from di Kwame Nkrumah University of Science and Technology (KNUST), Kumasi, Ghana, wit BSc in Land Economy - and e get PhD in Land Law.
Dr Mahama bin serve as Head of di local goment service wey dem bring out of di Ghana Civil Service for 2007.
E bin also become di coordinator of di Inter-Ministerial Coordinating Committee on Decentralisation (IMCC) Secretariat, wey dem create for 2011 to drive Ghana decentralisation agenda.
Im work closely wit di president and oda ministers of state wey dey di committee.
As di head of di local goment service, Dr. Mahama na ex-officio member of di Transition Team wey see how Ghana successfully transition from di National Democratic Congress administration of di sixth goment of di Fourth Republic of Ghana to di New Patriotic Party administration of di seventh goment of di Fourth Republic of Ghana for January 2017.
Dr Mahama na Lecturer from di Department of Land Economy of di KNUST between 2004 and 2007.
E work for di last John Mahama administration and e go now serve as di Executive Secretary to di president.
Di appointments
Anoda ogbonge appointment na Augustus Goosie Tannoh wey go serve as Presidential Advisor and go dey responsible for driving di 24-hour economy and accelerating export development.
Remember say President John Mahama dey particular about di 24-hour economy wey e promise Ghanaians.
Di appointees dey as follow:
1. Julius Debrah – Chief of Staff
2. Dr. Callistus Mahama – Executive Secretary to di President
3. Prosper Douglas Bani – Head of Interim Security Taskforce
4. Dr. Valerie Sawyerr – Senior Presidential Advisor, Governmental Affairs
5. Augustus Goosie Tannoh – Presidential Advisor Responsible for 24-hour Economy and Accelerated Export Development
6. Marietta Agyeiwaa Brew – Legal Counsel to di President of Ghana
7. Hon. Felix Kwakye Ofosu – Acting Spokesperson to di President.
How John Mahama become president
Di Ghana Electoral Commission bin declare former president John Mahama as di president-elect of Ghana.
Mahama of di National Democratic Congress (NDC) beat oda presidential candidates wey contest for di 7 December 2024 election.
Chairpesin of Ghana Electoral Commission Jean Mensa make di announcement for Accra.
Former president Mahama, 65-years-old defeat im closest rival wey also be di outgoing vice president of Ghana, Mahamudu Bawumia of di den ruling di New Patriotic Party (NPP).