Late Nigerian bank mogul Herbert Wigwe funeral start wit 'emotional' night of tributes

Di burial rites of former CEO of Access Bank Holdings, Herbert Wigwe, im wife Chizoba and son Chizi don start.
Di programme of events wey di family bring out, start on Monday for Lagos, Nigeria commercial capital.
Dem call di first day of di event 'Herbert Wigwe: Celebrating Professional Excellence'.
Many ogbonge pipo including govnor of Nigeria highest bank, richest black man in di world, oga of Afrexim Bank and many, state govnor, goment officials, stakeholders and pipo from di business industry attend di night of tributes of di di Nigerian businessman.
Access Holdings announce di death of dia Group Chief Executive Officer, Dr Herbert Wigwe last month. Dem say e die for one helicopter accident for America.

Wia dis foto come from, X/ Herbertwigwe
Govnor of di Central Bank of Nigeria, Yemi Cardoso tok say im get di opportunity to interact wit Herbert for di last few months and Herbert bin visit am two times.
"Im concern show about how im fit help to reduce di challenges wey di Nigeria economy bin dey face.
"I go kontinu to value di professional contributions im make for our meetings and also appreciate how insightful and thoughtful dem be."
End of Di one wey oda users dey read well well
Yemi Cardoso say on of di memories of late Herbert Wigwe beyond business na im involvement for di National Arts Theatre project.
"E get genuine concern for di welfare of our nation and di pipo"
Dangote shed tears as e pay tribute to im 'mentee'
Anoda ogonge business man, wey also be one of di richest men for Africa, Aliko Dangote showface for di night of tributes.
E describe di late Herbert Wigwe as im "broda and loyal friend".
"Herbert na visionary leader and perfectionist wey give so much of imsef, even though im no dey hia wit us again, we dey see im transformative stride all over our economic landscape and even di world".
Among all oda good tins , im bin be a pillar of strength and support for me, my family and our business dem.
Im no dey tire to comot from im comfort zone to tie all di knots for our company as we begin to grow.
Im dey proud to be part of my success story and I also dey proud to call am my devoted friend and broda. E dey hard to find anoda Herbert" Dangote explain.
Dangote shed tears wen im tok say im owe Hetbert plenti 'thank you' and even though Herbert no join military, im dey very courageous.
'Time bin stand still in honour of Herbert Wigwe' - Aig
Ogbonge pipo for di business industry showface for di night of tributes. One of dem na Aigboje Aig-Imoukhuede.
Aigboje Aig-Imoukhuede wey be Nigerian banker, businessman and investor cry as im pay tribute to im friend.
For im tribute im tok say time bin stand still wen im friend and brother comot from dis world last month.
"My broda and partner Hertbert tok publicly about im belief say time no dey wait for anybody.
Herbert live im life like pesin wey dey on a mission wey get short time to complete im work.
Even though im be man wey be di best of di best Herbert still dey worry if im get enough time to achieve all im dream.
As di tori about dis accident start to spread across di world time bin stand still in honour of Herbert Wigwe".
Herbert Wigwe death make all of us as human beings to reflect on our collective humanity.
Herbert death make millions of pipo wey sabi am and anoda hundreds of millions of pipo wey no sabi am at all, make dem to tink about di African leader and to understand di full potential of wetin im bin wan do for humanity.
Im death also make di world know say Africa fit still produce outstanding men and women."
Aig add say even though Herbert, im wife and son die, di way dem take honour am no be wetin dem dey see evritime for Nigeria history
Oda pipo wey tok for di night of tributes na President of di Africa Development Bank Group, Akinwumi Adeshina.
E say "Evritin wey Herbert touch dey turn to gold.
Govnor of Lagos state, Babajide Sanwo-Olu add say di late Herbert Wigwe 'Dey Completely detribalised; Lagos no go forget Herbert Wigwe,'
Nigeria Minister of Finance and Coordinating Minister of di Economy Wale Edun describe di late Herbert Wigwe as "Pesin wey get plenti ideas and dey creative for im thinking".
Herbert Wigwe, im wife and son die on 9 February, 2024 for helicopter crash.
Na for United States wey di plan crash as dem bin dey go di Super Bowl LVIII championship for Las Vegas.
Authorities say bad weda affect di helicopter wey kill all passengers on board including di two pilots.
Full burial programme
Di burial programme schedule go run for seven days according to di family. E go end wit Outing service on Sunday 10 March, 2024
Celebrating Chizi Wigwe
Tuesday, March 5, 2024
Celebrating Chizoba Wigwe
Tuesday, March 5, 2024
Night of Tributes
Wednesday, March 6, 2024
Combined Service of Songs
Thursday, March 7, 2024
RCCG, Ressurection Parish,
Christian Wake-Keeping
Friday, March 8, 2024
Wigwe University, Isiokpo
Combined Funeral Service
Saturday, March 9, 2024
Private Interment Ceremony
Saturday, March 9, 2024
Outing Service
Sunday, March 10, 2024
RCCG, Lion of Judah Parish, Isiokpo
Herbert Wigwe Profile

Wia dis foto come from, X/HERBERT WIGWE
Herbert Wigwe na di co-founder and Group Chief Executive Officer of Access Holdings PLC, wey dey offer financial services for sectors in Africa, Asia and Europe.
Di journey of Wigwe to become one of Africa top corporate banker bin begin wen im complete im accountancy degree from di University of Nigeria for Nsukka.
Im get Masters for Banking and Finance from di University of North Wales (now Bangor) and anoda Masters for Financial Economics from di presigious University of London.
Wigwe na alumnus of di Harvard Business School Executive Management Program.
Im study law for University of London. Na from Coopers and Lybrand for Lagos im begin im journey as a management consultant wey make am qualify as a chartered accountant.
Im first work for Capital Bank bifor im join GTBank wia im spend ova a decade to work for corporate and institutional banking.
E rise to become di Executive Director wey dey in-charge of institutional banking.
Wigwe get clear experience for di banking sector, im collabo wit Aigboje Aig-Imoukhuede to buy into Access Bank for 2002 at di time wey di bank dey rank 65th largest bank in Nigeria.
Wigwe begin im leadership tenure for Access Bank as Deputy Managing Director, before im succeed Aig-Imoukhuede as di Group Managing Director/CEO for 2014.
Im hold dat position until 2022.
For dat eight-year period wey im lead Access bank, Wigwe and im team of leaders carry Access Bank to become Africa largest retail bank (by customer base) for sub-saharan Africa.
Access bank also become one of di top 500 financial institution brands for di world, according to one 2022 report by Brand Finance, afta di bank don get operations for 12 kontries across di world globe.
For Africa alone, Wigwe bin lead di bank to 60 million customers.
Wigwe na also di Chairman of di Access Bank UK, wey don dey become a very strong African Bank for di United Kingdom.
Im also dey di board of Nigeria Business Coalition Against AIDS as member wey dey lead major businesses for Nigeria to fight HIV/AIDS within di health system and di private sector workforce.
For 2021, Wigwe bin receive recognition as African Banker of di Year, for di second consecutive year.
Dat same year again, di Global Brands Magazine Award recognise am as di ‘Best Banking CEO’ wia im also receive di Juris Law Award by di Juris Law Office sake of im contributions to corporate governance and rule of law for Nigeria banking industry.
During di COVID-19 global crisis, Wigwe act by co-leading di formation of CACOVID (Coalition Against COVID) wia dem establish 39 isolation centers across the 36 states of Nigeria including FCT Abuja and also feed 10 million families across Nigeria.
Im launch 'The HOW Foundation' for 2016. Wigwe also launch di Wigwe University
Im bin get five children wit im wife Doreen Chizoba Wigwe.














