You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Police arrest one of di major suspects allegedly involved in brutal killing of gallant DPO Bako
Police for Rivers State don arrest one suspect in connection wit di killing of SP Bako Angbashim for di Ahoada area of di State.
Police tok tok pesin SP Grace Iringe-Koko confam di arrest for statement on Tuesday.
She say dem catch one of di suspects on Monday 25 September 2023 wen dem get intelligence report say angry mob bin wan lynch am afta dem gbab and put tyre for im neck.
She say Police team go rescue di suspect and later transfer am go di State Criminal Investigation Department (SCID) to kontinu investigation.
Iringe-Koko dey expect to get informate from di suspect wey fit lead to di kingpin wey dem dey call ‘2-Baba’ and oda gang members.
Some weeks ago di Rivers State Police Command reveal di face of di pesin wey dem say na prime suspect for di killing of di divisional police officer for di state.
Di Rivers State goment also place N100 million bounty for di arrest of di killers of SP Bako Angbashim.
Rivers state govnor Similaye Fubara bin declare Gift David Okpara Okpolowu aka 2-Baba and im gang members wanted for di alleged killing of SP Bako Angbashim, wey be di divisional police officer of Ahoada Division.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di suspect chop accuse say im lead di 'Iceland cult' gang to ambush and murder di superintended of police.
Tori be say SP Bako and im team bin run into ambush wen dem bin dey return from one operation wia di suspect '2-Baba' and im gang allegedly attack dem.
Govnor Fubara tok say 2-Baba and im gang shoot SP Bako, capture am and eventually kill am.
“Credible intelligence from di security agencies bin trace di entire incident to one Gift David Okpara Okpolowu (a.k.a. 2-Baba) and im criminal gang, wey don establish camps for di locality and dey responsible for di resurgence of violent crimes, including kidnapping and terrorism for Ahoada East Local Government Area of di State.”
Di death of di superintended of police still dey cause tok-tok for di state as pipo wey sabi SP Bako describe am as gallant officer.
Di govnor tok say im goment no go fold dia arms and “allow criminals and crimes to rear dia ugly heads and thrive for any part of our state”.
Six suspects chop arrest
As police dey find di killers of DPO Bako, officers for di state on Saturday arrest six suspects in connection wit di murder.
Di arrest come afta di police raid Odiemudie community forests wia jaguda pipo bin kill SP Bako.
Tok-tok pesin for di state police command SP Grace Iringe-Koko, tok say objective of di raid na to recover Bako deadi bodi and also do assessment of di community.
She tok say dem arrest six suspects within Odiemudie community and dem seize one local pistol and many charms.
“Di Commissioner of Police, Rivers State, CP Nwonyi Emeka Polycarp, along wit im management team and tactical units, conduct one operation on Saturday, 9 September 2023, at approximately 0600hrs for Odumude Community, Ahaoda East LGA, Rivers State wit di objective to recova di deceased DPO’s bodi and conduct an on-the-spot assessment of di community.
“During dis operation, six suspects bin dey apprehended within di community. Among di items seized na one locally crafted pistol and various charms. Dis suspects and di confiscated items dey currently under police custody and dem dey undergo interrogation at di State CID, Port Harcourt.
“As a result of dis developments, residents of dis community don komot, e she tok.
Iringe-Koko also tok say while investigation dey continue, police don deploy anoda DPO to di division.
SP Zuokumor Richard na im dey in charge of di division and dem don give am di mandate to recover di corpse of di murdered DPO and also recova di operation weapons of di jaguda pipo.
Who be SP Bako Angbashim?
SP Bako Angbashim come from Nasarawa State.
Im be di Divisional Police Officer in charge of Bori Division and e help fight criminal and cult activities wey bin dey notorious for di Ogoni area of Rivers State before im redeployment to Ahoada Division to fight di same activities for dia.