How to keep safe as thunder strike kill secondary school students for Awka

E never dey possibly clear how thunder lightning bin dey strike pesin, e dey obvious say na always deadly situation if e hit pesin.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Lightning dey always occur wen unstable atmosphere mix wit water and warm air wey dey rise

Thunder lightning na one of di fearful cause of death wey don kill different pipo for different places and plenti pesin never sabi how dem fit keep safe from am.

E never dey possibly clear how thunder lightning bin dey strike pesin, e dey obvious say na always deadly situation if e hit pesin.

For Saturday, tori enter say thunder lightning bin kill three students for Awka Anambra state.

Di students wey be nine in number na from Tansi International College and dem dey play football for field wen di kasala bin happun as rain dey fall.

Tori be say three of di students wey no fit survive am bin die while dem try quickly revive di oda six of dem.

Wen BBC Pidgin bin reach di school, plenti crowd don gather for di compound - some parents dey desperate to see dia pikin afta di incident.

Wetin dey cause lightning?

Lightning dey always occur wen unstable atmosphere mix wit water and warm air wey dey rise, according to BBC science focus.

Wen longer hours of sunshine don heat di ground, di warm and liquid air wey dey above di ground level go dey less dense dan di cooler and dryer air wey dey above. Dis go make am rise.

As e dey go up, water vapour go begin dey cool and condense into water droplets wey go cause cloud dey form. E go begin dey release heat wey go dey create powerful upward current.

Di temperature go begin dey increase as e dey go up and e go dey spread to for di shape of wetin we know as thunder clouds. As more water vapour dey condense outside di cloud, di water droplet begin dey merge as ice particles also form into freezing.

Na wen di water droplet and ice particles dey heavy e go begin dey fall as rain while also generating cold air and strong wind.

But as dis dey happun, di collision wey go happun between ice crystals and water droplets go knock electrons off wia e go transfer am as bigger ice particles.

Di negatively charged particles bin dey sink and di positively charged go dey rise wia di bottom cloud go come accumulate opposite charges. Na dis one go create voltage, wey be say if e high e fit discharge lightning for inside di cloud.

Dis cloud wey dey negatively charged fit push back di electrons go ground to create a positive charge. Di voltage fit discharge reach ground from di cloud and na di heating of di air dey cause di rumble of thunder wey dey follow di flash of light.

How lightning dey strike pipo

Na different pipo don die by thunder lightning, but no be plenti pipo sabi how di lightning dey strike.

Direct Strike

According to study, direct strike of lightning fit occuer to pesin wey dey for open area. E no too dey common like oda ways but na di most deadly.

Di heat wey di lightning produce fit move over di skin and cause burns and di current wey pass through di skin na very heavy one.

Side Flash

For dis one, di current of di lightning go strike di taller object near di victim wia a part of di current go enter di victim. E dey happun wen di victim no too far from di object wey lighting strike. Many times, na wen di vitim go find safety under tree during raining period.

Ground Current

Dis kain lightning fit even kill farm animals as di current dey always strike along di ground surface. Dis one dey always affect a larger part of di ground and e fit enter di body through di nervous system. Na how far di objects dey to di ground na so di injury dey plenti and farm animals dey always get big body wey dey close to di ground.

Conduction

Na dis kain lightning dey travel through wires and other metal materials. Although, metal no dey attract lightning but e fit provide path wey light go follow. Many of di indoor lightning casualties na through conduction becos anyone wey dey in contact wit metal wires wen di thunder dey strike dey at risk. Dis also include electrical wires, phones and even doors.

How you fit keep safe

For 2018, at least 16 pipo die immediately and many pipo bin wound after thunder strike one Seventh-Day Adventist church for Rwanda. Na 140 pipo dem rush go hospital and dia district health centre.

Di heavy rain wey hit Ghana for 2021 bin kill three pipo.

Di big issues na how to keep safe wen lighting dey happun.

-You gatz stay off phones wey get cord or any electrical equipment wey fit put you for direct contact wit electricity.

-E dey important to stay away from doors and windows. Na why dem dey warn small children make dem no dey stay for door side wen rain dey fall.

-E no dey safe to lay ontop concrete floors or walls- you gatz stay away.

-If na outside you dey wey lighting dey show, comot from any place wey dey high like mountains or hills.

-No lie for ground and no go stay under any tree for shelter.

-Comot for water either swimming pool, lakes or ponds.

-No go near any material wey get electricity for body like wired fences, power lines and more.