How pipo react to Wizkid son Champz new EP Champion's Arrival?

Picture of Tife for wetin resemble abandoned building for cover art shoot

Wia dis foto come from, Instagram/@official_tifebalogum

Read am in 3 mins

Social media don full wit tok-tok afta Grammy Award winner, Wizkid first born son decide to enta di music industry wit brand new Ep.

On Tuesday, 11 November, Boluwatife Balogun, wey im stage name na Champz, drop im first EP wit five tracks wey im name Champion's Arrival.

Im papa wey don get anoda Grammy nominatoon for di 2026 Award show comment on am as e dey sign fan autographs say, "na my pikin be dat".

Champz new EP wey tori be say don cross one million streams in di first day since im release speak on plenti topics like how im mama dey support im dreams, accusation say e be Nepo baby bicos im papa na Wizkid and wetin e dey plan do for di music industry.

Pipo don dey tok about di EP sotay one big social media user say no be am at all howeva many odas don disagree, say di EP na beta gbedu.

Odas still dey ask weda Wizkid get mouth for di production on top say e neva post about di mata for any of im socials.

Dem tok say e still be Tife first time for di music scene and efit build more experience as e dey go.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 1

Skip X post, 2

End of X post, 2

Skip X post, 3

End of X post, 3

Skip X post, 4

End of X post, 4

Boluwatife Balogun don dey for spotlight since dem born am for 2011.

Wizkid bin even carry am waka for stage for im December 2017 show wey im do for Lagos.

Dis no go be di frst time wey big musician for Nigeria go get dia pikin dem to follow in dia footsteps.

For one Fela Kuti two sons Femi and Seun join am to dey make music sotay Seun Kuti inherit di papa band, Egypt 80 and even sef Fem Kuti pikin Made don join di music industry.

Anoda one na IK Dairo wey dey commonly called di Papa of Juju music, wit some of im popular songs like Hungry for love.

Between di late 1990s and early 2000s, im pikin Paul Play Dairo blow up wit RnB songs like Angel of My LIfe.

Even wit dis Nepo energy, Champz no gree say e be part of dem, as e tok for di second track for di EP wey im call Grind, "And they was calling me a Nepo, I agree to disagree".