Six pipo die odas injure for Ghana military recruitment crush

section of the recruits outside the el-wak stadium
Wetin we call dis foto, Many oda potential recruits injure wey dem dey receive treatment for hospital
Read am in 3 mins

One crush during military recruitment exercise for Ghana don kill at least six pipo and injure odas.

Di incident hapun for di El-Wak sports stadium near di military camp wia thousands of young pipo bin gada for di recruitment exercise on Wednesday.

Videos for social media videos on Wednesday bin show long queues for street as pipo bin turn out as early as 2:00am to form di line for di recruitment.

Di Ghana Armed Forces inside one statement wey confam di incident tok say di pipo wey injure dey receive treatment for di 37 military hospital.

"Our first investigation show say di plenty numbers of applicants wey wan enter di military choke for di El-Wak stadium, wey dem breach security protocol to rush inside di gate ahead of di exercise around 6 AM.

Medical teams dey work hard to stabilise those wey dey affected, wey and we dey make arrangement to inform di families of those wey die."

Di recruitment exercise still dey go on as di service tok say dem dey begin di documentation and body selection exercise from 12-13 November for di various screening centres.

military hospital
Wetin we call dis foto, Five pipo dey critical wey 12 odas dey out of danger

President Mahama visit victims for hospital

Ghana president John Mahama visit di victims for di 37 military hospital togeda wit some top govment officials.

He direct say make di military halt di recruitment process until further notice.

Opposition and oda civil society groups dey call for investigation into di tragedy.

Di acting defense minister and his deputy and di minister for govment communication join di president for di visit.

Commander for di 37 military hospital Brigadier General Evelyn Vivian Abraham-Kwabiah tok journalists say "di casualties in total be 28 pipo, six die, five odas dey critical and 12 odas dey fairly critical wey di rest dey stable and out of danger."

She tok say dem go provide healthcare for di victims wey dem carry go di hospital.

some of the applicants walking away
Wetin we call dis foto, Di military now scata di crowd of potential recruits wey dem ask dem to return on Thursday for Airforce pipo, Friday for Navy and Saturday for Army applicants
The president checked on the victims at the 37 military hospital

Wia dis foto come from, GHANA PRESIDENCY

Wetin we call dis foto, President Mahama direct say make dem halt di recruitment process afta di tragedy
The military say they are offering the victims the best care

Wia dis foto come from, GHANA PRESIDENCY

Wetin we call dis foto, Di recruitment process currently dey on hold
The Chief of defence staff briefed the president on the matter

Wia dis foto come from, GHANA PRESIDENCY

Wetin we call dis foto, Dis be di first time in recent history wey many pipo die for di military recruitment process
Some of the victims who are out of danger engage with president Mahama

Wia dis foto come from, GHANA PRESIDENCY

Wetin we call dis foto, President Mahama tok say all di deceased be female