NLC ask goment to reverse as NNPC adjust fuel price across Nigeria for di third time in one year

NNPC filling station
Read am in 3 mins

Nigeria Labour Congress don tell goment to sharpely reverse di new petrol price.

NLC President Joe Ajaero tok inside statement say, ‘’di previous increase no produce any good result’’.

Oga Ajaero add say instead, ‘’pipo dey poor more and more’’.

NLC challenge goment to go back to di drawing board and bring out proper plan for economic growth and national development instead of all dis scattered palliative policy.

NLC reaction dey come as some Nigerian National Petroleum Company Limited filling stations don adjust dia fuel prices.

Most NNPC filing stations for Lagos, Nigeria commercial city and di Federal Capital Territory no dey sell 897 naira ($0.52) per litre fuel again.

BBC News Pidgin tori pesin see say di national oil company don adjust dia fuel price to 998 naira ($0.52) for Lagos and 1,030 for Abuja.

NNPLC neva tok anytin about fuel increase but dis na di third time wey dia filling stations go increase fuel price – dis na di second time within one month.

In September di Nigerian National Petroleum Company Limited, NNPC Ltd release wetin dem say be di estimated pump price of petrol across Nigeria based on September 2024 pricing from di Dangote refinery.

Dis come as Dangote begin dia first petrol loading from dia Refinery.

For di statement dem release, di graph wey dey attached show say some states go buy from N950-N1200. But just about a month afta, di prices don change.

NNPC retail buying portal

Wia dis foto come from, NNPC retail buying portal

NNPC estimated pump price as at September

NNPC filling station

Lagos - 950. 22 naira per litre

Oyo - 960.22 naira per litre

Imo - 980.22 naira per litre

Rivers - 980.22 naira per litre

FCT - 992.22 naira per litre

Kaduna - 999.22 naira per litre

Kano - 999.22 naira per litre

Sokoto - 999.22 naira per litre

Borno - 1,019.22 naira per litre

Nigerians reacts to new petrol price

Many Nigerians also no happy about di increase in fuel price, di news come as shock to dem.

Pipo don take to social media to express dia feelings like Aliyu Halimsaliyah wey tok for X say, ’’na every market day fuel dey high since di protest’’

While Laface say, "pipo like Mele Kyari suppose resign and leave dat office dem be total failure".

For Chris @CEO_Chrysolite e say, ''im meet fuel at N195 afta a year and some months now na N1030''

Activist Deji Adeyanju say, ''fuel now na N1,030 but nobody want to chase clout by protesting. Everybody dey wait for pesin to start protest''.

Vreng @its Vreng say, ‘’Nigerians na di only pipo on earth wey dey barely pay tax, but expect US standard of facilities and subsidies’’.

@Uncle_Fineboy @FineboyUncle say ‘’T-pain you dey do well, raise am raise am raise am, next time wen we speak, una go hear word. till 2031’’.

Skip Facebook post
Allow Facebook content?

Dis article contain content wey Facebook provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Facebook cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Facebook post