Who be di five candidates wey wan replace Adesina as president of African Development Bank

Dis na di five candidates wey dey run to become di next president of Afdb

Wia dis foto come from, Getty Images/abbastolli.com/sammaimbo.com/Cyril Ramaphosa

Wetin we call dis foto, Dis candidates wan become di next president of Afdb
Read am in 5 mins

Di African Development Bank (AfDB) don announce di official list of candidates wey dey contest to become di next president of di bank.

Na five candidates AfDB don clear to contest for di top seat wey go replace Akinwumi Adesina wey don be president since 2015.

Di bank release di name of di candidates on Friday 21 February, 2025, from five different African kontris.

According to AfDB, di election go take place for 29 May, 2025.

African Development Bank na ogbonge bank wey dey work to improve di quality of life for di pipo of Africa and also to support Africans, especially women and young pipo to fulfill dia potential.

Di bank dey also loan money to different African kontris to help dia economy grow.

For June 202, African Development Bank (AfDB) bin approve loan of 288.5 million dollars to Nigeria.

Di money wey pass 111. 7 billion Naira na to help tackle coronavirus for di kontri dat time and make goment plan to improve response to di virus emergencies dey stronger.

According to AfDB, na di steering committee for di election bin clear di five candidates wey dey contest for di top seat.

"Di Steering Committee of di Board of Governors on di Election of di President of di African Development Bank meet on 11 and 12 February 2025 for di Bank Group headquarters for Abidjan, Côte d'Ivoire."

Na afta dem examine di candidates, na im di steering committee come clear dem to dey qualify for di office of di president.

Di five AfDB candidates and dia kontri

Mr HOTT Amadou, Senegal.

Dr MAIMBO Samuel Munzele, Zambia.

Mr TAH Sidi Ould, Mauritania.

Mr TOLLI Abbas Mahamat, Chad.

Ms TSHABALALA Bajabulile Swazi, South Africa.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Hott Amadou - Senegal

Amadou Hott dey in front of mic wit im suit and tie

Wia dis foto come from, Getty Images

Amadou Hott na 2025 candidate for di Presidency of di African Development Bankis na ogbonge executive wit ova 25 years of experience for economic policy, development finance, and investment banking.

E get degrees for applied mathematics, economics, and financial markets.

Hott bin serve as Senegal Minister of Economy, Planning and Cooperation (2019-2022).

E also represent di African Union for G20 Finance Ministers and Central Bankers meetings for Indonesia.

Maimbo Samuel Munzele - Zambia

Maimbo Samuel from Zambia on glasses

Wia dis foto come from, sammaimbo.com

Maimbo Samuel Munzele na from Zambia and e get ova three decades of experience for development finance and resource mobilization.

E don serve for position as Vice President for Budget, Performance Review, and Strategic Planning for di World Bank, wia e ensure fiscal discipline to manage dia operational budget of US$5 billion.

Maimbo don serve as Chief of Staff to different World Bank presidents and don spend 23-year tenure for di World Bank, Dr Maimbo wia e hold plenti influential positions

E get a PhD for Public Administration Banking, an MBA in Finance and a Bachelor degree in Accounting.

Tah Sidi Ould - Mauritania

Sidi Ould in front a mic wit im stripe tie

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Tah Sidi Ould

Tah Sidi Ould na from Mauritania wia e don serve as di Minister of economy and finance and Minister of economic affairs and development for di kontri between 2008 to 2015.

E don also serve as an Advisor to both di President of di Republic and di Prime minister of Mauritania from 2006 to 2008).

TAH na holder of a PhD in Economics and also complete executive programs for Investment, Leadership, Asset Management, and Financial Engineering.

E dey speak Arabic, French and English languages and get knowledge of Spanish and Portuguese.

TAH na bifor govnor for Mauritania for di World Bank, di Islamic Development Bank, di African Development Bank, di Arab Fund for Economic and Social Development.

Tolli Abbas Mahamat - Chad

Abbas Tolli wit pink tie dey look into di air

Wia dis foto come from, abbastolli.com

Tolli Abbas Mahamat na from Chad and e dey contest to be president for di African Development Bank.

From 2005 to 2008, e serve as Chad Secretary of State, den Minister of Finance. E later become di kontri Minister of Infrastructure and Equipment from 2011 to 2012.

E don serve as Secretary General of di Banking Commission of Central Africa.

For 2015, e become President of di Development Bank of Central African States (BDEAC) and den for 2017, dem appoint am as govnor of di Bank of Central African States (BEAC).

Tshabalala Bajabulile Swazi - South Africa

Tshabalala Bajabulile Swazi wit smile on her face

Wia dis foto come from, Cyril Ramaphosa

Tshabalala Bajabulile Swazi na from South Africa and dey contest for AfDB top seat.

She get ova three decades of experience for financial and banking sector.

Na she be di only woman wey dey di candidate list for AfDB presidency.

She be senior vice president for African Development Bank and she dey paasionate about issues of women.

Tshabalala get di support of South African president Cyril Ramaphosa wey dey present her as dia candidate.

Eight tins to sabi about AfDB outgoing president Akinwumi Adesina

Im be di first Nigerian to lead AfDB

Dem elect am for five-year term for September 2015

Im be Nigeria agriculture minister from 2011 until im move

Dem name am Forbes Africa Person of di Year for 2013 for im "bold reforms" for farming sector

One teacher for Nigeria bin tell am say im no go ever enta Purdue University sake of say im maths dey poor

He prove am wrong as im enta di ogbonge US institution

He cancel im admission to UK ogbonge Cambridge University

He get im PhD for agricultural economics for 1988