Seychelles declare state of emergency afta huge explosion

Seychelles President Wavel Ramkalawan don declare state of emergency for di kontri, afta one very heavy explosion plus flooding happun for one industrial zone on di main island, Mahé.
Di Seychelles leader don order all citizens except essential workers to siddon for house.
Plenty pipo injure sake of di explosion.
Di blast happun for one construction and quarrying company, wia dem dey store explosives, di explosion cause serious havoc for di industrial zone of Providence.
Di international airport also dey affected, even though e dey 4km (2.5 miles) away.
Schools dey closed and di only movement wey dey allowed na into and out of di holiday islands.
"Di Seychelles international Airport still dey operational and ferry services between islands dey work for visitors," di kontri official account post on X.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
UK government don advice dia citizens for di island of Mahé to remain indoors until further notice.
End of Di one wey oda users dey read well well
One unusual heavy rain wey fall overnight bin cause serious flooding and landslides.
Three pipo die wen dia houses destroy.
Di flood don cause dirty to flow inside ocean and authorities don advise pipo say make dem no swim.
President Wavel Ramkalawan as e dey tok on national TV call di twin disaster "calamity" for di kontri, and beg pipo to show solidarity to those wey di mata affect.
Seychelles kontri profile

Di Seychelles dey made up of 115 islands and e be di least populous kontri for Africa wit about 100,000 pipo.
Di Indian Ocean archipelago dey enjoy high per capita income, good health care and education.
Di former British colony economy depend heavily on di fishing industry and big market tourism.
Seychelles also na home to different wildlife, including giant tortoises and sea turtles. Much of di land dey protected as part of nature reserves.
REPUBLIC OF SEYCHELLES: FACTS
- Capital: Victoria
- Area: 459 sq km
- Population: 100,447
- Languages: English, French, Seychellois
- Life expectancy: 72 years (men) 82 years (women)















