'Dem go see pepper' - Guinea-Bissau president react to coup attempt for im kontri

Wia dis foto come from, AFP
Guinea-Bissau president say heavy gunfire wey break out for di capital on Friday na attempted coup.
Im bin dey out of di kontri dat time, dey attend di UN COP28 climate conference in Dubai.
On Saturday, President Umaro Sissoco Embaló promise "serious consequences" for pipo wey get hand for di mata.
Dis na di second failed coup against im leadership in under two years. Di unrest begin late on Thursday evening into Friday mid-morning.
Dem don gbab one man wey dem describe as di leader of one group of sojas wey bin try to free one detained minister and one senior state official for Guinea-Bissau, di military tok.
Members of di National Guard bin take di officials before dem seek refuge for barracks south of di city.
Special forces den intervene for di mata afta attempts to negotiate bin fail, dis result in exchange of gunfire.
Dem later restore calm for di area.
End of Di one wey oda users dey read well well
Finance Minister Souleiman Seidi and António Monteiro, di secretary of state for di treasury, chop detention sake of investigations into di alleged irregular withdrawal of $10m (£8m) of state funds.
Anti-corruption inquiry question dem on Thursday afternoon to clarify di payments to 11 companies.
For parliamentary session on Monday, di leader of di kontri main opposition party alleged say di owners of di companies bin dey close to leaders of di kontri governing coalition.
Oga Seidi defend di payments say e dey legal.
On Thursday afta di questioning, Oga Seidi and Oga Monteiro chop arrest and detention so dat dem no go jeopardise di investigations, local media tok.
later dat evening National Guard sojas bin invade di police cells, wey dey located near Bandim market, "wit AK-47 weapons and bazookas" and free di detained officials, di privately owned O Democrata news outlet report.
E say diNational Guard carry dem go unknown location.
On Friday morning, regional stabilisation forces wey di the regional West African bloc Ecowas deploy bin dey patrol di streets, na so tori pipo AFP news agency report.
Guinea-Bissau don suffer series of coups and attempted coups since dem gain independence from Portugal for 1974.
For February last year, President Embaló say im survive a coup attempt afta im bin dey under heavy gunfire for five hours - dat incident 11 pipo die.
But im no provide details, E say di attack dey linked to drug trafficking for di kontri.
Some pipo bin doubt di official version of di events, as dem no really answer di questions wey include who bin really dey behind di attempt, how many pipo bin dey involved and who bin dey in command.
Alberto Dabo, one journalist for Bissau, wey tok to BBC's Newshour programme, directly link di recent events to wetin happun last year.
"After di coup attempt, many high-ranking officials for army wey dem bin hold responsible for di mata go jail without any judgement. And some high-ranking members of di army dey demand for dia freedom," Im tok.














