Wetin we sabi about King Charles cancer diagnosis

King Charles don dey diagnosed with one form of cancer, according to Buckingham Palace.

Dem find am for im recent treatment for enlarged prostrate.

Di King don start treatment and dey advised by im doctors to postpone public facing duties for now.

Which kain cancer di King get?

Di Palace neva tok which kain cancer di King get, or wia e dey collect treatment.

Dem say e bin start "schedule of regular treatment" on Monday.

For statement, dem say, "No more informate don comot at dis stage except to confam say His Majesty no get prostrate cancer."

E dey linked to im treatment for enlarged prostrate?

Di King, wey be 75, recently collect treatment for benign prostrate enlargement.

E spend three nights for London Clinic private hospital last month afta e go through "corrective procedure".

Afta di treatment, di Palace say di King go postpone im public engagements "to allow time for private recuperation".

Dem find "anoda separate mata of concern" for im treatment wey dem finally find as form of cancer.

E go now collect treatment for di second condition as outpatient.

Wetin be cancer?

Cancer dey hapun wen cells for one part of di bodi start to divide in uncontrolled way.

Dis cells fit spread to oda tissues for bodi wey include organs for wetin dem dey call secondary or metastic cancer.

How dem dey find cancer

Normally, doctors go first ask questions about wetin dey do you. Dem fit also do tests and examination join.

Dis fit include blood tests and X-rays or oda scans. Sometimes, dem dey take small tissue sample, wey dem call biopsy to use am run checks for lab.

Occasionally, like for di King, dem dey find cancer wen pipo do medical checks for oda tins.

Cancer fit dey diagnosed by tests wey screening ask for.

Di UK dey offer screening for breast, bowel and cervical cancer. Cancer screening dey find early signs of cancer for pipo wey no get symptoms.

Oda tests fit come confam di diagnosis.

How many pipo dey get cancer?

For di UK, one in two pipo go develop some kain cancer for dia life.

Ova 200 types of cancer dey ground.

And di most common ones for di UK na breast, lung, prostrate and bowel according to di NHS UK site.

Each cancer get particular way wey dem dey diagnose and and treat am.

Wetin be di main treatments for cancer?

Plenti ways dey to treat or manage cancer. E sha depend on di type of cancer and wia e dey.

Some cancers fit dey removed by surgery, while dem fit give chemotherapy drugs for drips or tablets to kill di cancer cells.

Radiotherapy na anoda option wey fit dey on offer. E dey use high energy rays to attack di cancer.

Not all di treatments fit cure am sha.

Wetin be di different stages of cancer?

Staging na how doctor dey take explain how big di cancer don grow reach and how far e spread, and na im go decide how dem go take treat am.

Staging fit use numbers, wia one na wetin dem dey call small cancer wey neva spread and four wey mean say e dey advanced and dey spread round di bodi.