How Cote d’Ivoire take qualify, full list of all Afcon 2023 Round of 16 fixtures

Di group stage of di Afcon 2023 finally end on Wednesday night afta all di teams complete dia matches.

Di group games bin produce plenty surprises wey shock many pipo especially as kontris wey be favourites to win di tournament struggle wit lesser teams.

Afta all di games. Some kontris don comot while odas get luck to qualify to di next round sake of di new structure wey Caf introduce for di tournament.

Sake of dis, kontris like host, Cote d'Ivoire, Guinea, Mauritania, and Namibia wey carry third for dia groups eventually qualify.

All di four kontris qualify as best losers – Caf use points and one kain grading system wey automatically make di selection for di four 'best losers'.

So far, teams wey don qualify for round of 16 na:

  • Equatorial Guinea
  • Nigeria
  • Cape Verde
  • Egypt
  • Senegal
  • Cameroon
  • Guinea
  • Angola
  • Burkina Faso
  • Mauritania
  • Namibia
  • DR Congo
  • Ivory Coast
  • South Africa
  • Morocco
  • Mali

Afcon 2023 group stage results & tables

Full Round of 16 Fixtures

Di Round of 16 fixtures for di Afcon 2023 go start on Saturday up to Tuesday - di first game of di round na between Angola vs Namibia .

See di full fixtures;

Angola vs Namibia - 27 January for Stade de la paix in Bouake

Nigeria vs Cameroon - 27 January for Felix Houphouet Boigny Stadium in Abidjan

Equatorial Guinea vs Guinea - 28 January for Alassane Ouattara Stadium

Egypt vs DR Congo - 28 January for Laurent Pokou Stadium.

Cape Verde vs Mauritânia - 29 January for Felix Houphouet Boigny Stadium.

Senegal vs Ivory Coast - 29 January for Charles Konan Banny Stadium.

Mali vs Burkina Faso - 29 January for Amadou Gon Coulibaly Stadium.

Morocco vs South Africa - 30 January 30 for Laurent Pokou Stadium.