Meet woman wey born two set of twins, nine single children and now quintuplets

Collage of Hajara and her twins

Wia dis foto come from, Shuaibu Umar

By Mansur Abubakar

For Katsina state inside northwest Nigeria ,some pipo don begin call Hajara Shuaibu di most fertile woman for Nigeria afta her latest delivery see her born five children on Wednesday.

Hajara wey her tori spread for her community and even outside tok to BBC Pidgin about her experience.

According to her, she bin no know say she dey expect more dan one baby and she follow her normal routine.

She no ever go for ante-natal and she born for house, assisted by di local birth attendants wey dem dey call Unguwan zoma for Hausa.

She say na afta she born for house before dem carry go Funtua General Hospital as precaution.

“Na for house I born, na afta dem carry me go hospital wia dem infuse blood for me and tell me to rest, all my previous births too na for house.”

“All my children na for house I dey born dem without single operation.”

Wetin we call dis Video, 'I fit carry belle for anybody'

Hajara wey tok say she be ordinary housewife without any business yan say she no get diet or routine wey make her dey born like dis.

“Na just God, no be say I dey chop sometin special wey dey give me plenty babies.” She tok.

She also call on goment and individuals to come to dia aid as dem need helep to take care of di babies.

“Anytin wey anybody fit give go helep us because we need help to take care of di babies.”

Di latest addition for Hajara
Wetin we call dis foto, Di five children wey Hajara deliver on Wednesday

Shuaibu Umar na Hajara husband and e tell BBC Pidgin say two of di new borns die on Thursday but di remaining three and di mother don move to Federal Medical Centre Katsina wey dem go get beta care.

“Dem no get incubators for Funtua to put di babies na why dem tell us to move to Katsina and now di children dey get di care dem need.”

Shuaibu wey be farmer for Doma village say e consider children as blessing and im wife no get any particular diet or routine wey make her dey born born like dis.

E also tok say chairmo of Faskari local goment for Katsina don helep dem with N100,000 but dem still need helep to take care of di large family.

Shuaibu Umar
Wetin we call dis foto, Shuaibu Umar say di family need helep to take care of di new born

Umar Hussaini na Hajara father and e tok say e marry off im daughter 21 years ago.

“Hajara na 35 years old and she marry 21 years ago so regarding her plenty births I go tok say na gift from God.”

Asking Hajara if she go give birth again, she tok say no be her hand e dey.

“Na God get everytin if e don tok for my destiny say I go born again e go happun.”

Hajara born 18 children
Wetin we call dis foto, Hajara say children na blessing from God

Tori of anoda woman wey born 17 times but still want more

Jummai Ibrahim wey dey stay Kano, north west Nigeria get 17 children.

She bin tok to BBC fsay in her next life she go like born more dan 17 children because children na blessing from God.

BBC Pidgin bin interview her on World Population Day for 2020.

Di housewife yan say on UN World Population Day, she dey proud say she get a high number of children and she dey pray make God continue to bless dem.

“On a day like dis, I dey very happy and proud say i born up to 17 children and wetin pipo suppose no be say I born all di children by myself without any operation. Seven don die but 10 dey alive now."

"I marry 30 years ago and I get 2 grand children. Many wey no know me no go believe say I don reach 17 by mere looking. None of the childbirths come with any complications I thank God."

“To pipo wey dey shout say world population don too plenti and na reason for food shortages for some places, I tell dem say no be true, Children na blessing and if i go come for next life i go like born more dan 17.”

Jummai na housewife wey dey take care of her children for house and her husband plus some of di children wey don grow dey comot go look for food and money for dem.