Seyi Awolowo tok 'sorry' afta backlash over comment e make for reality show

Seyi Awolowo

Wia dis foto come from, @officialseyiawo/Instagram

Comment by reality show participant don dey make many pipo para for am.

Seyi Awolowo na one of di Big Brother Naija ‘All stars’ housemates, reality show wey get attention of many young pipo and women.

Di tin wey Seyi tok make pipo vex sotay di Lagos State Domestic and Sexual Violence Agency come out to sharpaly drop warning against di comment and anybody wey get dat kain intention.

Video emerge on Sunday wia Seyi dey tell oda housemates why im want only male pikin.

For di video wey don go viral on social media, di BBNaija housemate make reference to gender difference - wey make e be like say male pikin na 'alpha'.

E further tok about wetin im go want make im male pikin dem do di female gender.

“We strongly condemn di comments wey Seyi Awolowo make for di disturbing video wey don dey spread.

“Such remarks perpetuate harmful attitudes and contribute to a culture of violence and abuse,” di Lagos State Domestic and Sexual Violence Agency.

Di agency no spare di oda housemates wey dey listen to Seyi without caution.

“Di bystanders passive response in di video dey also deeply concerning becos e dey only enable such behaviour to kontinu. E dey important for us all to actively tok out in situations like dis,” DSVA add.

Beside di agency reaction, oda civil society groups and non-governmental organizations dey also chook mouth for di matter.

Social media users including fans and followers of di BBNaija show dey also para.

‘Grandson’ as many pipo dey call Seyi don dey trend for social media.

Reaction to Seyi comment

Wia dis foto come from, Screengrab/Twitter

Wetin we call dis foto, Reaction to Seyi comment
Reaction to Seyi comment

Wia dis foto come from, Screengrab/Instagram

Reaction to Seyi comment

Wia dis foto come from, Screengrab/Facebook

Coversations wey housemates dey get for di show dey either cause controversy or dey totori pipo.

BBNaija followers dey make some of di show highlights to trend - something wey dey mostly dominate social media conversations for Nigeria.

E neva clear weda Multichoice, di organizers of di show go react to di development.

Seyi big brother naija apologize

Sake of how di matter don generate reaction di management of Seyi Awolowo don apologize.

For statement wey dem issue on Sunday say Seyi no be di kain pesin wey some pipo dey reason am to be.

Dem say di video wey dey circulate dey complete and e no fully cover all di tins wey di reality TV star dey discuss wit im fellow housemates.

“E dey important to recognize say di edited content remove some tins and dis one fit don make pipo dey quote am out of context.

We gree say Seyi fit don tok something wey dey triggered, provoked and influenced by some tins. E dey important say wetin happun dia no define who im be.

Seyi no be woman beater, woman oppressor or cultist as some pipo dey tok,” Omotola Ayodeji wey sign di statement tok.

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post

Seyi Awolowo profile

Seyi Awolowo na from Ogun state South west Nigeria and dem born am for December 1989.

Im na entrepreneur, reality TV celebrity, and social media influencer.

Tori be say Seyi come from di lineage of late Chief Obafemi Awolowo, one of di founding fathers of Nigeria.

Seyi inclusion for di 2023 all stars edition if BBNaija bin totori fans on top say e bin dey serve as bartender for dia weekly parties.

Anoda ogbonge moment for im time for di house na im friendship wit Tacha afta dem fake evict both of dem.