Thank una!
Time don reach for us to go.
Match don end. Champions don emerge!
Spain na di ogbonge Champions of di world.
We thank una for staying with us throughout di coverage of di Fifa Women World Cup 2023.
Spain make history as dem defeat England to win dia first ever World Cup.
Jelilat Olawale
Time don reach for us to go.
Match don end. Champions don emerge!
Spain na di ogbonge Champions of di world.
We thank una for staying with us throughout di coverage of di Fifa Women World Cup 2023.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wia dis foto come from, Getty Images

Wia dis foto come from, Getty Images

Wia dis foto come from, Getty Images

Wia dis foto come from, Getty Images

Wia dis foto come from, Getty Images

Wia dis foto come from, Getty Images
Spain, for dia first ever final, don win di World Cup.
After all di off-field issues, di team no too dey for great shape just 10 months ago.
But now, dem be world champions.
Tears of joy for di Spaniards and tears of disappointment for di Lionesses.
Dat na di last action of di match and Spain don win di World Cup.
England players sink to dia knees as Spain bench flood di pitch.
Brilliant goalkeeping as Cata Coll come out to collect.
What dey play?
England win one corner.
Jorge Vilda points to im watch.
Mary Earps dey up. Chai
Beth England no fit get dia. Millie Bright try to keep am alive but e no too work.
Dem add 13 minutes.
Thirteen minutes for England to turn dis around. Thirteen minutes for two nations to hold their breath.
England fit turn tins around for dis minutes?
England make anoda change.
Bethany England dey replace Ella Toone to give di Lionesses dat much needed outlet.
Jenni Hermoso don dey come back on after receiving a bit of treatment.
Boos dey ring round Stadium Australia as Olga Carmona tackle Lauren James from behind on di edge of di area.
Referee say make dem play on.
Beta ball from Lucy Bronze on di right of di penalty area but no one dey dia.
Dat na where England go miss Alessia Russo.
Dem announce over di speakers say 75,784 dey watch di match live inside Stadium Australia.
England don manage to ginger small small.But dem go need to keep dat up.
Lauren James pick up di ball from Chloe Kelly and hit her shot high towards di corner of di net.
She force Cata Coll into a good save for her near post.
Corner.
Lucy Bronze lashe one effort from range but e sail over di bar.
Up di oda end, Mary Earps beat Salma Paralluelo to stop di attack.
Spain comot Laia Codina for Ivana Andres.
What a save! Mary Earps save di gaol.
Spain miss di chance to lead England by anoda gaol.
Jenni Hermoso fire low for di right-hand corner and na absolutely perfect save from Earps.
Spain don win penalty for Keira Walsh hand ball.
Spain come forward, na pinging around for di box and oh no. Dis no dey look good for England o.
Di Spain bench dey protest for a hand ball.
E look like e hit Keira Walsh hand as Mariona Caldentey hit di strike for di di penalty area.
VAR go look at dis.