Investigation reveal wetin cause deadly helicopter crash wey kill govment officials and crew for Ghana

Acting Defense minister Dr Cassiel Ato-Forson handover report to presient Mahamaa

Wia dis foto come from, GHANA PRESIDENCY

Wetin we call dis foto, Di investigative board say apart from di poor weather, di aircraft no get some safety equipment
Read am in 5 mins

Investigation into di 6 August helicopter crash for Ghana wey kill eight govment officials and crew show say poor weather cause di accident.

Di report reveal say di Z-9 helicopter crash on dat day sake of dem lose height wen dem reach one area wey get hill for di forest on dia way to Obuasi when dem dey go launch govment programme against illegal mining.

Di aircraft crash di hill at 1,370 feet above sea level, about 6.5 miles from dia destination for Obuasi.

But di committee also find say di Z-9 helicopter even though e dey air-worthy, no get additional safety tins wey go help di pilot to fly for difficult weather.

Dis be some of di findings of di investigative board wey also tok say di Airforce no get flight data monitoring system, wey dem no dey do simulator training.

Di investigative board also recommend say make di Airforce upgrade dia aircraft fleet.

portraits of the eight government officials who died

Wia dis foto come from, GHANA PRESIDENCY

Wetin we call dis foto, Di committee recommend say make Ghana invest for modern aircraft and equipment for di Airforce

Some of di findings and recommendations by di board

Di board of investigation get di national security, Ghana Armed Forces, aircraft accident incident and investigation bureau as well as di USA Airforce staff.

Di board chook eye for evidence, eyewitness accounts, flight maintenance records, data and voice recorder (wey dem carry go di AVIC flight decoding centre, Xian - China for analysis).

According to di investigation, di flight crew dey fit wey dem get ova 24 hours of rest bifor di flight.

  • Di captain delay take-off sake of poor weather for Accra, Kumasi and Obuasi
  • Throughout di flight, dem change di altitude to avoid low clouds
  • No information about di weather along di flight dey available to di pilot when he dey fly
  • Witnesses tok say di fog and rain for di area cause poor visibility
  • Di helicopter dey good condition wey dem declare am serviceable

Di helicopter lack safety equipment

  • Di Z-9 helicopter no get terrain awareness and warning systems
  • Di aircraft no get advanced navigation wit terrain mapping
  • Di flight no get automatic flight control system
  • Dis safety equipment could have enhanced situational awareness
file photo of a military aircraft in Ghana

Wia dis foto come from, GHANA AIR FORCE

Wetin we call dis foto, Di investigative committee recommend say make di govment buy new aircraft wit modern equipement for di Airforce

Safety recommendations

  • Di kontri for buy modern aircraft wey get modern navigation systems
  • Dem for get flight data recorder and cockpit data recorder wey fit record video and audio
  • Di kontri for invest in flight simulators for training
  • Di kontri for get certified aviation weather provider
  • Di kontri for get flight data monitoring
  • Di kontri for get ground support equipment and tracking systems

Tok-tok pesin for di investigative board Captain Paul Fordjour explain say make di kontri implement dia recommendations to prevent future accidents like dis one wey kill eight pipo.

Background of wetin happun on 6 August

For 6 August 2025, one Z-9 helicopter from di Airforce wey dey carry govment pipo and ministers from Accra, crash killing everibody on board.

Di two cabinet ministers – Dr Edward Omane Boamah (defence minister), Dr Ibrahim Murtala Mohammed (environment minister) togeda wit deputy national security coordinator (Muniru Limuna) and deputy director for di kontris disaster management organization (Samuel Aboagye) dey on dia way to Obuasi to launch one govment programme against illegal mining.

Dr Samuel Sarpong – first vice chairman for di govment national democratic congress (NDC) party and three Airforce crew members Squadron leader Peter Bafemi Anala, Flying officer Twum Ampadu and Sergent Ernest Addo Mensah dey among di pipo wey die dat day.

During dia state funeral president John Mahama promote di service men posthumously to recognize dia service to di kontri.

Squadron Leaser Peter Bafemi Anala – new rank Wing Commander Bafemi Anala

Flying Officer Manaen Twum Ampadu – new rank Flight Lieutenant Twum Ampadu

Sergeant Ernest Addo Mensah – new rank Flight Sergeant Addo Mensah

parliamentarians, government officials and a section of the public at the state burial

Wia dis foto come from, PARLIAMENT OF GHANA

Wetin we call dis foto, Di kontri organize state burial for di eight victims wey dem open welfare fund for di wives and children of di victims

Dem open Welfare fund for wives and children of di victims

Di president also open welfare fund to raise money for di wives and children of di eight gallant men wey die for dat crash.

Inside di last update by di coordinator for di fund Dr Valeri Sawyerr on 17 October, dem tok say di fund get GHc 8.6m ($787k) and anoda $20k.

Dis moni be from govment agencies, individuals, companies and oda NGOs.

Ghana dey battle wit illegal mining (galamsey) wey destroy di kontris water bodies and forest reserves.

Many pipo say dis be di time govment go take serious action to stop di mata – afat di death of di eight govment officials and helicopter crew.

Since di accident, environmental groups, di opposition party and oda civil society groups dey demand say make di president declare state of emergency for places wey di illegal mining scata di rivers and forests.

According to di experts, dis go make di govment target those areas to deal wit di problem wey e go help to restore di kontris water bodies wey dey poisoned wit mercury, lead and cyanide wey di miners dey use.

But di president say di time no reach to declare dis state of emergency sake of di govment dey use oda methods like using soldiers and water guards to deal wit di mata.

Dem arrest many illegal miners wey dem seize hundreds of equipment wey di illegal miners dey use for dia activities on top water bodies.