Zulu king express regret afta viral video show as e dey para for im wife

Wia dis foto come from, PHILL MAGAKOE/POOL/AFP via Getty Images
- Author, Wedaeli Chibelushi
- Published
- Read am in 4 mins
South Africa Zulu king don express "deep" regret afta one leaked video show as e dey sama im third wife wit big-big insults.
Di video wey bin go viral on Wednesday, show as King Misuzulu kaZwelithini bin dey threaten to beat Queen Nomzamo Myeni, as e accuse her of cheating. E say make she comot for di house.
Di queen wey be like say na she dey feem di video, no tok anytin until di end of di video, wen she say: "Dis na di life I dey live, day and night".
On Friday, one statement from di king office tok say e know say di outburst cause "pain" and "embarrassment" among royal circles and di broader Zulu ethnic group.
"E dey important to clear am say di recordings na old video and e no represent di present circumstances within di Royal Household," di statement tok.
For di video, King Misuzulu bin dey para for im wife wey e marry last November, say she go for excursions witout im approval.
"She dey out dia witout my permission. Wen you be wife, you suppose ask for permission. At least let your husband know," e tell di queen.
Afta e don insult di queen repeatedly, e tell am say im get girlfriend wey dey wait for am.
"I want you out," e tok, as e comot di room.

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images
E neva dey clear who release di video to di public space.
Di statement from di royal household tok say on di video leak, di king and queen bin dey receive some politicians as part of dia official duties.
Engagements like dis show say di "difficult circumstances" wey dey captured for di video don settle and e dey replaced by "reconciliation" and "reflection", di statement add.
Regarded as di "lion of di nation", di Zulu king na di custodian of age-old traditions wey put marriage and polygamy for di heart of royal success.
Im role within South Africa fit only be ceremonial, but e still get big influence, wit yearly govment-funded budget of several million dollars.
Di video bin cause sharp divide on social media - some bin accuse di king of displaying abusive and undignified behaviour, while odas condemn di queen say why she go bring private matas to di public.

Wia dis foto come from, KwaZulu-Natal government/Facebook
South African journalist Asanda Magaqa say while she no go eva encourage anyone to feem private moments, "watching dat video, I understand why she bin dey compelled to record am".
"No woman deserves to live like dat," she write on social media platform X.
Di footage also show di king dey say become king through witchcraft. King Misuzulu coronation dey come afta one year-long family feud, as some royals argue say no be im be di rightful heir and say dem forge im papa will.
Zulu society dey deeply patriarchal, and women often dey expected to comply wit traditional gender norms.
South Africa get one of di highest rates of violence against women for di world.
Last year, South Africa bin classify gender-based violence (GBV) as "national disaster".
Dem delay di king marriage to Queen Myeni for months last year as e bin dey deal wit one scandal wey involve im first wife, Queen Ntokozo kaMayisela.
Queen kaMayisela bin go court as she attempt to stop di wedding. She argue say her husband go dey commit di offence of "bigamy" if e no first "convert" im civil marriage to her to traditional Zulu marriage.
But di judge bin throw her case out of court. E say Queen kaMayisela get "turnaround" in attitude as she bin don already agree say her husband fit take oda wives.
Additional reporting by Khanyisile Ngcobo for Johannesburg










