17 pipo die for South Africa mass shooting

One police man dey hold yellow tape tied to an iron

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 3 mins

Na seventeen pipo dem kill for one mass shooting for one small South African town.

South Africa police say dem don begin dey find di pipo wey get hand for di killing.

Two big farms for di town of Lusikisiki for di Eastern Cape na im dem bin target, according to di police.

Pipo wey die for di location number one na 12 women plus one man, and three women and one man die for di second location.

Di 18th victim dey critical condition for hospital, South Africa Police Service tok.

Di police ministers and commissioner go brief di kontri for 13:00 Saturday local time (12:00 BST).

South African media outlets say di victims na relatives and neighbours for Nyathi village, Ngobozana for Lusikisiki.

Tori be say di group bin dey togeda for di house wia dem dey prepare to attend one traditional mourning ceremony wen di attack bin happun on Friday night.

Tori pipo Dispatch Live bin quote local Ingquza Hil mayor, Nonkosi Pepping wey say: "Di gunmen come and begin shoot anyhow killing evri one. Women and children dey among pipo wey dem kill for di bloody shooting.

"Dis don leave fear for evri one bodi for di community."

South Africa Police Service tok-tok pesin Brigadier Athlenda Mathe tell Newzroom Afrika say na total of 19 pipo bin dey sleeping inside two houses for one of di shooting locations.

She say six survivors dey for one farm - four women, a man, and two months old pikin wey bin dey injured but dem take dem to hospital for precaution. Survivor no dey for di oda farm.

Officials neva sabi wetin cause am and dem neva still make any arrests.

Brig Mathe say: "We get one team of detectives wey already dey ground. We get one team of experts wey dey come from Pretoria and go land for Lusikisiki, to investigate, to collect all evidence wit aim of arresting pipo wey get hand for dis wicked attacks."

Cabinet member for community safety, Xolile Nqatha, tell goment tori pipo SABC say im hope say di man wey seriously injure go make "speedy" recovery, as "im recovery fit help us shed more light" on di shooting.

Im also suggest say di victims fit sabi di pipo wey shoot dem.

South Africa get one of di highest murder rates for di world, according to di latest numbers from United Nations Office on Drugs and Crime.

For 2022 alone, dem get more dan 27,000 murders - dat na 45 pipo inside evri 100,000, out of population of almost 60 million. Dis one high compare to US rate of six per 100,000.