Video of di big space object wey fall enter one village for Kenya

Video of di big space object wey fall enter one village for Kenya

Sabi pipo from Kenya space agency dey investigate one 500kg metal ring wey crash into Earth on Monday.

Di object bin fall enter Mukuku village, 50km (31 miles) south-east of di capital, Nairobi.

Report say nobody injure for di crash.

Di Kenya Space Agency say dia initial assessment show say di big object na "separation ring from a launch vehicle (rocket)".

Dem add say e dey "usually designed to burn up as dem re-enta di Earth atmosphere or to fall ova unoccupied areas, such as di oceans".

Follow us on Twitter @BBCPidgin, on Facebook at BBC News Pidgin , on Instagram at bbcnewspidgin, and Whatsapp Channel