South Africa politically connected businessman Brown Mogotsi escape plenty bullets

Wia dis foto come from, SABC
Police for South Africa dey investigate alleged shooting incident wey involve controversial businessman Oupa Brown Mogotsi wey reportedly survive attack for Vosloorus on Monday night.
Di service say dem put togeda team wey dey chook eye for di mata, afta di tori break say one red Chevrolet Sedan car wey oga Mokgotsi bin dey travel, suffer gun fire by some pipo wey dey drive along di Vosloorus highway.
Di car allegedly get bullet holes but di businessman escape wit out wound.
Media outlet for South Africa, di capetownetc quote Police toktok pesin Brigadier Athlenda Mathe as she confam di incident.
"We don open case of attempted murder."
Brown Mogotsi dey expected to make formal statement to di police as investigations kontinu for di scene of di attack, according to SABC news.
Police toktok pesin inside one interview wit journalists explain say "oga Mokgotsi tok say im dey alone wen di white bakkie follow him wey dem begin to shoot at his car."
Athlenda Mathe add say "our investigative team dey estimate say dem fire about 11 rounds at di car but dem still dey di scene dey collect evidence."
"Di acting station commander don call oga Brown Mogotsi again for di last few minutes to check on am and weda he go come di station to write im statement but im no dey answer im phone at di moment."
Some pipo no dey rule out di fact say Brown Mogotsi fit stage dis attack, as pipo no dey trust am.
One journalist bin ask, what if police find say na stage acting wey happun, di police go charge di businessman?
Na so di police toktok pesin Athlenda Mathe say "absolutely, we go charge am, sake of dat dey defeat di essence of justice. If we dey send police resources for dis mata, dat be diversion of resources we ft carry go anoda place. So if we find say he bin stage dis tin, den we go charge am."
Athlenda Mathe also add say afta dem check di car, dem no find any blood stain wey mean say oga Mokgotsi no hurt or get injury for di attack.
Who be Oupa Brown Mogotsi?
Oga Brown Mogotsi na businessman wey im name feature inside di Madlanga commission of inquiry togeda wit di parliament Adhoc committee wey dey investigate allegations of corruption for di criminal justice system for South Africa.
Tori for di kontri media say oga Oupa Brown Mogotsi dey allegedly linked to claims of influence peddling, dis mata show for di Madlanga Commission wey investigate interference of govment officials during investigations into political killings.
Im name also appear inside oda ogbonge investigations into corruption and interference for di police service.
Im dey politically connected for di kontri, wey sabi pipo and opposition leaders tok say im closeness to ogbonge officials dey raise kwesions about di integrity of police work.
For dis mata, police say any pesin wey get information as witness or dashcam or phone videos to help dem wit dia investigations.
For October, some media for South Arica report say police raid di business office of Brown Mogotsi for Seweding Village near Mahikeng as part of investigation into alleged corruption and political interference.
Afta dat raid for im business office, Mogotsi tok journalists say im fear for im life as he allegedly describe wetin police dem do as "targeted harassment".
For di past Mogotsi bin describe imserf as businessman and pesin wey dey volunteer for di ANC.
But on 4 October, di African National Congress (ANC) tok inside one statement say dia membership records show say oga Mogotsi no be member of di party sake of im membership expire.
Dis be afta allegations say im dey involved for organized crime.
"We distance ourserf from any form of organized criminal activity. Crime and corruption be enemies of democracy. Di ANC neva go allow dia name to be associated wit pipo wey betray di principles of our movement for dia personal gain," di ANC statement wey toktok pesin Mahlengi Bhengu-Motsiri sign, tok.
Di 69- year-old former MK (Umkhonto we Sizwe) operative don become ogbonge power broker wit influence ova govment tenders and police matters from im base for Seweding, Northwest province.










