You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Airport workers call off strike for Kenya main airport
Airport workers for Kenya go return to work afta dia deal wit goment. Dis na wetin Transport Cabinet Secretary, Davis Chirchir, workers union leader, Moss Ndiema and Cotu boss, Francis Atwoli announce.
E mean say normal operation go resume for di Jomo Kenyatta International airport and di airport of Mombasa, Kisumu and Eldoret wia passengers bin dey stranded well-well on Wednesday.
Airport workers for di Jomo Kenyatta International airport and oda airports bin go on strike.
Di strike affect hundreds of passengers sake of one planned takeover by one Indian company.
According to local media for Kenya, part of di deal wey di workers get wit goment to to resume work na make goment chook eye well-well inside di documents wey contain details of di proposed 30-year Jomo Kenyatta International airport lease.
Di lease deal na wit Indian conglomerate Adani Holdings.
Wetin be di deal dem make wit goment
According to loaal media, di Cabinet secretary, Chirchir promise say dem go table di Adani deal for court wia dem don sue goment to allow dem to torchlight am openly.
"We go work togeda to build points of convergence, we get agreement. We know say dem don carry us go court. We go now present all di documents for court to make sure say di public understand" im tok.
For di resolution wey Mr Atwoli read, di team agree to give di workers union 10 days to chook eye for di documents wey concern di Andani deal bifor dem go hols anoda meeting wit stakeholders.
"Di outcome of di tok-tok afta 10 days go determine di way forward" na wetin di Cotu oga tok.
Goment don also agree to enta salary negotiations wit di union and also collective bargaining agreement in two months time.
Di union leader wey be Mr Ndiema tok say di deal wey dem reach no mean say worker dey okay wit di Adani deal.
"We neva tok say we accept am" Im conclude.
Wetin bin happun
Passengers bin stand for long queues outside di Jomo Kenyatta airport as dem bin dey wait in front of closed door for di Jomo Kenyatta International Airport (JKIA) on Wednesday morning.
Di aviation workers union dey oppose Kenya goment proposal to lease Jomo Kenyatta International Airport (JKIA), for Nairobi give Adani group for 30 years.
Afta union members waka comot on Wednesday morning, airlines delay plus cancel flights wey make plenti passengers hang for airports.
But di goment bin defend di proposal, say di airport dey operate beyond capacity and dem need private investment to upgrade am.
For one statement, JKIA say: "As of 7:00am, minimal operations bin resume. for di meantime, we dey discuss wit relevant parties to normalise operations. We apologise for any inconvenience wey dis cause and appreciate your patience and understanding during dis time."
Some fotos of di strike
Hundreds of workers begin demonstrate on Wednesday as planes remain grounded.
Di goment bin tok say di build-and-operate agreement wit India’s Adani Group go see di Jomo Kenyatta International Airport renovated, and and go ensure additional construction of runway and terminal, in exchange for di group running di airport for 30 years.
Kenya Airport Workers Union wey announce di strike say di deal go lead to job losses and “inferior terms and conditions of service” for dose wey go remain.
Kenya Airways on Wednesday announce say flight delays and possible cancellations go dey sake of di ongoing strike for di airport, wey dey serve Nairobi.
Last week, airport workers bin threaten to go on strike, but di plans bin dey called off pending discussions wit di goment.
Di spotting of unknown pipo moving around wit airport officials taking notes and photographs bin raise concerns say di Indian firm officials bin dey ready for di deal, local media outlets bin report last week.
Di High Court on Monday temporarily stop di implementation of di deal until a case filed by di Law Society and di Kenya Human Rights Commission dey heard.