Osimhen score hatrick as Nigeria waya Sao Tome & Principe 6-0

Super Eagles

Wia dis foto come from, CAF

Victor Osimhen hatrick help di Super Eagles of Nigeria beat di Falcons and True Parrots of São Tomé & Principe wotowoto for di 2023 Africa Cup of Nations qualifier.

Di ruthless Super Eagles whip dem 6-0 for di match wey shele for di Godswill Akpabio International Stadium, wey pipo sabi as di Nest of Champions for Uyo, Southern Nigeria today.

Victor Osimhen and Ademola Lookman score for di first half.

Taiwo Awoniyi goal, Victor Osimhen penaly kick, anoda second half goal from Osimhen and Samuel Chukwueze seal victory for di Super Eagles.

Victor Osimhen finish as top scorer for di 2023 Afcon qualifiers with 10 goals.

Nigeria wey bin don already qualify bifor di match, finish dia qualifying series in style a dem top Group A wit 15 points.

Guinea Bissau finish second wit 10 points while Sierra Leone , Sao Tome and Principe no qualify.

Sao Tome and Principe lose all dia matches na only one draw dem get.

How di match happun

Second half

Full Time Nigeria 6:0 Sao Tome and Principe

90+3 Referee don blow whistle, match don end.

90+2 Marcos Babeiro of Sao Tome and Principe fall for ground wen no body touch am , e don waka comot from field.

90+1' Game don continue afta Sao Tome and Principe player bin dey for ground afta e receive medical attention.

87' Nigeria Super Eagles dey show Sao Tome and Principe pepper for dis match.

Nigeria 6:0 Sao Tome and Principe

86' Goal! Samuel Chukwueze score goal number 6.

Nigeria 5:0 Sao Tome and Principe

80' Victor Osimhen score hatrick for Nigeria

80'Goal! Victor Osimhen don score di 5th goal for dis match. Na also im third goal for di day.

76' Anoda goal opportunity come for Nigeria but Victor Osimhen play am into di hands of di Sao Tome and Principe goal keeper.

71' Substitution for Sao Tome and Principe Eba Viegad don replace Denilson Silva.

Nigeria 4-0 Sao Tome and Principe

70' Goal! Victor Osimhen score from di spot.

65 Substitution! Joe Aribo don enta for Frank Onyeka.

65' Substitution! Taiwo Awoniyi don comot, Victor Boniface replace am

61' Wilfred Ndidi play di freekick wit pass wey hit di defence wall of Sao Tome and Principe.

60' Freekick for Nigeria against Sao Tome and Principe.

57' Nigeria continue to dominate di match wit beta team play.

Nigeria 3-0 Sao Tome and Principe

51' Goal! Taiwo Awoniyi score Nigeria third goal.

46' Referee don blow whistle to signal di beginning of second half.

First Half

45+1 Referee don blow whistle to end di First Half

45+1 Match don continue as Ricardo Fernandes stand up.

45' Sao Tome and Principe player Ricardo Fernandes dey ground dey receive medical attention.

44' Nigeria still dey control di ball and di pace of di game.

43' Nigeria collect di ball ftrom dia leg wey result to foul as Referee blow im whistle.

43'Sao Tome and Principe dey play short short passes to drag Nigeria out from goal area.

42' Goal kick for Sao Tome and Principe.

39' Victor Osimhen goal attempt result to corner kick but dem play am wide.

Di tempo of di game don reduce small as Nigeria Super Eagles slow down di game to breath.

36' Kelechi Iheanacho play corner kick for Nigeria but Sao Tome and Principe defence clear di ball.

Victor Osimhen dey worry Sao Tome and Principe defence.

Nigeria 2:0 Sao Tome and Principe

28' Goal! Ademola Lookman don double di lead for Nigeria. E score from Wildred Ndidi assist. Lookman dribble all di pipo wey dey near net, before im cool down fire di shot inside di box.

25' Goal just dey smell anyhow for Sao Tome and Principe net as Nigeria continue to dominate di game.

23' Nigeria dey control di ball well well, Sao Tome and Principe player bring Taiwo Awoniyi down near di box but Referee say play on!

17' Chance ! for anoda goal but Victor Osimhen miss am.

Nigeria 1:0 Sao Tome and Principe

14. Goal! Victor Osimhen score for Nigeria. E play di ball enta net from cross wey come from corner kick.

13' Kelechi Iheanacho play di corner kick for Nigeria but Ola Aina play di ball towards di net wey deflect.

10 ' Sao Tome and Principe don collect di first Yellow card of di match as Adjakson Ranco give Frank Onyeka bad tackle.

8' Ademola Lookman play di corner kick but notin come out.

7' Taiwo Awoniyi get chance to score but di ball deflect go corner kick.

5' Nigeria dey dominate possession for di midfield.

2' Sao Tome and Principe start wit initial gragra.

1' Referee don blow whistle match don start.

Match stats

Head to Head

Nigeria and Sao Tome and Principe don meet only one time and na for di 2023 Afcon qualifiers match day two.

Sao Tome and Principe bin collect wotowoto 10-0 for from Nigeria.

Di match happun for di Adrar Stadium for Agadir, Morocco for June, 2022.

Victor Osimhen shine well well for dat match as im score four goals for Nigeria during di match.

Sao Tome and Principe bin don lose 4 out of dia last 5 matches, dia best result na 2-2 draw against Sierra Leone.

Nigeria sef win only 3 of dia last five matches.

Victor Osimhen na di top scorer for di 2023 Afcon qualifiers.

Im don score seven goals so far and im dey look forward to increase im tally for dis last match day.

Starting Line up

Nigeria starting Line up: 23 Francis Uzoho 2. Ola Aina 6. Ajayi 13. Onyemaechi 17. Bassey 4. Ndidi 8. Onyeka 7. Lookman 14. Iheanacho 19. Awoniyi 9.Osimhen.

Sao Tome and Principe starting Line up: 1. RonaldoSilva 2. Lucio Oliviera 4.Adjakson Rancho 5. Ricardo Fernandes 6. Aldaire cruiz 6.Ricardo Cardoso 7. Marcos Beibero 8. Denilson Silva 10. Luis Leal 11. Ronaldo Lumumgo 14. Rogeiro Fernandes