Joe Biden say im don decide US response to Jordan attack

Joe Biden

Wia dis foto come from, Getty Images

President Joe Biden tok say im don decide how di US go respond to one drone strike wey kill three American troops for Jordan ova di weekend.

Oga Biden tok am as e dey comot White House for fundraiser wey dey shele for Florida. E say "I no tink say we need wider war for di Middle East."

One Iran backed militia group don claim responsibility for di attack for di US military base.

Dozens more wound for di Sunday strike near di Syrian border.

Oga Biden no really tok di koko of wetin US go fit do but di White House on Monday bin promise a "very consequential response".

Sergeant William Jerome Rivers, 46, Specialist Kennedy Ladon Sanders, 24 and Specialist Breonna Alexsondria Moffett, 23

Wia dis foto come from, US DEPARTMENT OF DEFENSE

Wetin we call dis foto, Sergeant William Jerome Rivers, 46, Specialist Kennedy Ladon Sanders, 24 and Specialist Breonna Alexsondria Moffett, 23

Di drone strike na di first time wey US sojas go die from enemy fire for di region since di Israel Gaza war bin start for 7 October.

Iran bin deny say dem get hand for di attack.

Oga Biden tok yes wen tori pipo ask am on Tuesday weda e don decide how e go take respond to di attack.

Di tori pipo bin also ask weda Iran suppose dey blamed. E say: "I hold dem responsible sake of say dem dey supply di weapons to di pipo wey do am."

E get plenti choices like retaliatory strikes on Iran-allied bases and commanders.

Di US fit target senior commanders of Iran Islamic Revolution Guard Corps for Iraq or Syria.

Di overnight attack bin target one US military base wey dem dey call Tower 22 for north-eastern Jordan.

About 350 US forces dey stationed for di base, wey dey focused on supporting di coalition to defeat di Islamic State, according to US Central Command.

Di enemy drone bin strike wen one American drone dey return to di base afta one mission.

Officials say di base air defence auto-response features bin dey off so dem no go shoot di US drone.

But becos of dat, dem bin no get warning for di troops wey tori be say dem still dey for dia sleeping quarters.

Di strike bin kill 46-year-old, Sgt William Jerome Rivers, 24-year-old Specialist Kennedy Ladon Sanders and 23-year-old Specialist Breonna Alexsondria Moffett.

Ova 40 odas bin dey injured including 34 pipo wey officials say bin dey evaluated say dem fit get traumatic brain injuries.

In recent months, several US bases for di Middle East don dey attacked by militias wey dey trained, funded and equipped by Iran.

Di Islamic Resistance for Iraq claim responsibility for Sunday strike.

Di group, wey include penti Iran affiliated militias wey dey work for Iraq, tok say dem don target three US bases for Syria, Shaddadi, Tanf and Rukban.

Dem don also claim responsibility for oda attacks against US forces for recent weeks.

Di Iraqi goment don condemn di strike and dey call for "end to cycle of violence" for di Middle East.