WHO don declare highest alert ova outbreak of Monkeypox virus

Congolese scientists examining samples for the monkeypox virus

Wia dis foto come from, Getty Images

Di World Health Organisation don declare monkeypox as global health emergency.

Di classification na di highest alert wey di WHO fit give and dis one na because of increase of cases around di world.

Dem tok dis one for di end of di second meeting of di WHO emergency committee on di virus.

Dem don report more dan 16,000 cases from 75 countries, na so WHO director general Dr Tedros Adhanom Ghebreyesus dey tok.

So far five pipo don kpai sake of di outbreak, na wetin e follow tok.

Right now, dem only get two odas of dis kain health emergency - di coronavirus pandemic and di constant work to finish polio pata-pata.

Dr Tedros tok say di emergency committee no fit reach consensus (collabo ansa) on weda make dem classify di monkeypox outbreak as global health emergency.

But e come say di outbreak don spread around di world like wild fire and come reason say di mata concern di whole world.

Dem no too undastand di new modes of transmission wey don allow am spread, na wetin Dr Tedros tok.

"WHO assessment be say di risk of monkeypox dey moderate globally and for all regions, except for di European region, wia we don assess say di risk dey high."

No clear risk of extra international spread, and di risk say e fit interfere wit international traffic still dey low for now, na so e tok.

Dr Tedros say di declaration go epp speed up di development of vaccines and implementation of measures wey go reduce di spread of di virus.

Di WHO dey also issue recommendations wey dem hope go ginger kontris to take action to stop transmission of di virus and protect di pipo wey dey most at risk.

Dr Tedros Adhanom Ghebreyesus

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Dr Tedros Adhanom Ghebreyesus say stigma and discrimination fit dey dangerous as any virus

"Dis na outbreak wey we fit stop wit di right strategy for di right groups," Dr Tedros tok.

E say cases dey heavy for men wey dey pansh men, especially di ones wit plenty sexual partners, and kontris gatz adopt measures wey go protect dia health, human rights and dignity.

"Stigma and discrimination fit dey dangerous as any virus," na wetin e tok. 

Dem first discova Monkeypox for central Africa around 1950. 

First symptoms usually be high fever, swollen lymph nodes and blisters, chickenpox-like rash or lesions – for di mouth or blokos for recent cases.

Wetin be monkeypox?

Woman wey get Monkeypox

Wia dis foto come from, Getty Images

Monkeypox na disease wey monkeypox virus dey cause. E dey potentially serious and dey start wit flu-like illness and swelling of di lymph nodes.

Di sickness go later progress to a widespread rash on di face and body.

Most infections dey last 2 - 4 weeks.

Symptoms of Monkeypox

Initial symptom na fever, headaches, swellings, back pain, aching muscles.

Afta dis, rash go start and e dey start wit red areas on di skin, then e go begin swell, then to vesicles or blisters, and then to pustules, Dr Rosamund Lewis, di head of di WHO smallpox secretariat tok.

How monkeypox dey spread?

Monkeypox fit spread to humans from one infected animal like a monkey, a rat or squirrel.

Human-to-human transmission no really dey common, but e fit happun wen someone dey in close contact wit infected pesin.

Dem dey transmit di infection through broken skin, di respiratory tract, di eyes and di mouth.

Touching contaminated clothing, bedding or towels of pesin wit di monkeypox rash fit also spread di disease.