How burial of di late Olubadan of Ibadan take waka

Burial of Ibadan monarch Oba Olalekan Balogun

Dem don bury di late Oba Olalekan Balogun of Ibadan for im family house for Ali Iwo compound for Agodi/gate Ibadan.

Di Olubadan of Ibadanland, Oba Olalekan Balogun bin die late Thursday evening of 14 March.

Di 42nd Olubadan die some days afta e celebrate im second year coronation anniversary.

Na Dele Ogunsola, tok-tok pesin to di Olubadan confam di death of di 81-year-old Oba Olalekan Balogun on Thursday.

Oyo State gonor Seyi Makinde also confam di death of di monarch for anoda announcement wey e make.

Di govnor say Oba Balogun die for University College Hospital (UCH) Oyo state South West Nigeria.

Govnor Makinde describe di monarch as example of royal excellence and a great achiever, wey make great mark on Ibadanland in just two years of im reign.

“A mighty Iroko don fall; Oba Dr Balogun don join im ancestors,” di govnor tok.

E say “In Kabiyesi, Ibadanland get universal and well-experienced Olubadan, wey make im mark in di sands of history and achieve greatly within a small time.”

Tori come out say dem go do di burial of di Olubadan on Friday for Ibadan.

Kola Balogun, wey be brother of di monarch say dem go bury Late Olubadan for im Aliiwo ancestral home, according to Islamic rites.

Who be Lekan Balogun?

Ibadan monarch Oba Olalekan Balogun

Wia dis foto come from, Dele Ogunsola

Di Late Oba Olalekan Balogun na Nigerian politician, businessman and former senator.

Dem born Lekan Balogun for October 1942.

Balogun serve as board member of several major companies for Nigeria and overseas, especially for di oil, agriculture, trade, management and tourism sectors.

E once serve for various capacities for Shell Petroleum Development Company.

E get Doctorate, Master's and Bachelor's Degrees for Public Administration, Public and Social Administration, and Economics.

E attend Columbus International University, Brunel University and Manchester University, all di institutions dey for United Kingdom.

Di former senator bin serve as Research Fellow wit di Ahmadu Bello University, Zaria; Director wit Triumph Newspaper, Kano; Editor of di monthly Magazine - "The Nigerian Pathfinder"

On di political front, Balogun na former presidential aspirant on di platform of Social Democratic Party (SDP).

E also run as gubernatorial candidate for di PDP in Oyo State.

Balogun later become senator of di Federal Republic of Nigeria for di Fourth Republic.

Fotos from di burial of Oba Lekan Balogun

Olubadan burial
Olubadan burial
Olubadan burial
Olubadan burial
Chiefs siddon for Olubadan burial
Pipo siddon for Olubadan burial

Ibadan Oyo state - Wetin to know about Ibadan land and dia king

Ibadan na di political capital of present day Oyo State for south west Nigeria.

And na di third largest city by population for Nigeria afta Lagos and Kano.

Di city bin serve as di administrative centre for di old Western Region since di early days of British colonial rule.

Ibadan land don tanda for many 100s of years in history and pipo wey dominate Ibadan na Yorubas.

However, pipo from oda parts of Nigeria also dey live for di city.

Olubadan of Ibadan land na im be di most respected traditional leader for Ibadan land.

Before Balogun, Ibadan land don produce 41 Olubadan. Di last Olubadan reign for five years before im join im ancestors.

Di 39th Olubadan of Ibadanland na Oba Yinusa Ogundipe wey die in 2007 afta im ascend di throne on May 7, 1999.

Oba Samuel Odulana Odugade succeed Oba Yinusa as di 40th Olubadan of Ibadan land, and im die at for January 2016.