Lagos govnor Sanwo-Olu intervene for Mohbad death

Wia dis foto come from, Mohbad Instagram/Babajide Sanwo-Olu
Lagos State Goment don give total support to di Special Investigation Team, to torchlight wetin really cause di death of Nigerian musician, Ilerioluwa Oladimeji Aloba alias Mohbad, police tok.
Govnor of Lagos state Babajide Sanwo-Olu give assurance say im go lead di investigation into di death of Nigerian musician in all ways required, to guarantee proper and diligent investigation.
Tok-tok pesin for Lagos state Police Command, Benjamin Hundeyin for statement e share on dia official social media page say "Govnor Babajide Sanwo-Olu give di assurance wen im bin consult wit di State Commissioner of Police.
Di consultation wey happun on Saturday na to know how best to make sure say dem investigate di case thoroughly and deliver justice sharp sharp."
Di news of Mohbad death begin spread on Tuesday as many pipo begin chook mouth for di mata wit plenti questions.
Why police wan investigate di case
According to di statement wey Lagos state police Command tok-tok pesin post, police say dem wan chook eye well well, investigate di mata thoroughly.
Dis na sake of di "growing public concerns and di preliminary police review of di general circumstances wey sorround di death of Mohbad."
"Di Commissioner of Police, Lagos State Command, CP Idowu Owohunwa, don give order for full-scale criminal investigation into di case to start sharp sharp.
End of Di one wey oda users dey read well well
Na Special Investigation Team wey dey inside di Homicide Section of di State Criminal Investigation Department (SCID) go coordinate di investigation."
"Di team get homicide detectives, wey get di task to put all di allegations, suspicions and insinuations from various sources on di death of di singer togeda."
Dem go also undertake a professional, diligent and timely investigation wit a view to establish facts, clearing all doubts and make sure say dem serve justice."
Police add say "dem go use all requisite protocols wey fit include exhumation of di deadbody as well as technical and scientific tools wey dey vital to carry out detailed investigation of homicide allegations of dis nature."
Di Lagos State Police Command add say dem go share wit di general public how dem dey make progress for di investigation, at least to di extent wey dey legally and professionally acceptable.
Wetin Naira Marley tok
Oga of Marlian Music, musician Azeez Fashola AKA Naira Marley finally chook mouth on di death of im former signee, Ilerioluwa Aloba wey pipo sabi as Mohbad.
Musician Mohbad sudden death still be top conversation since e happu on Tuesday.
Naira Marley ontop statement wey e release for im Instagram page early mor-mor on Saturday call for thorough investigation into di death of Mohbad.
Naira Marley describe di death of Mohbad as loss to evribody, say dem owe Mohbad all di assistance to help uncover any foul play or injustice.
"As we share our condolence to di late Mohbad, we go like to echo a call for a thorough investigation into di circumstances wey surround im death. We dey unhappy and unsettled wit evritin wey we don witness since Tuesday di 12th of September. We owe it to Mohbad to assist to expose any foul play or injustice, our broda deserve a beta send off".
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
For inside di statement, Naira Marley also describe di late Mohbad as "Incredible street Pop star wey contribute to di foundation of Marlian Music."
Since Mohbad death, plenti tori and allegation don come out about bully and threats e endure afta e comot from Naira Marley record label.
Naira Marley make reference to di mata for im statement also.
Im say even though Mohbad comot from di record label last year, dem still continue to champion im talent.
"No family dey perfect, families dey get disagreements but we no wish Mohbad any harm. So many tins dey wey we no fit tok but di love always dey dia, dis tragedy no be only a loss for us but to evribody you touch musically around di world"
E explain say na wit heavy heart dem dey mourn di death of Mohbad wey get exceptional talent.
One popular show promoter for Nigeria wey chop accuse say e threaten and bully di late young musician, Mohbad, Sam Larry bin don come out to clear im name.
Sam Larry na Naira Marley padi-padi.
Mohbad death on Tuesday and di news of im death shock and vex many Nigerians sake of tori and allegations say e suffer bullying and im life bin dey threatened well-well before im death.
Di death of Mohbad wey bin sign under popular singer Naira Marley record label shake di music industry and im fans.
Samsom Erinfolami Balogun, wey pipo sabi as Sam Larry na one of di pipo wey chop accuse of bullying Mohbad and since im death, Nigerians don dey call for justice and say im get case to ansa.
But for one video wey come out on Friday, Larry tok say im no fit kill Mohbad and im no get anytin to do wit im death. E add say im love di singer so much and God see im heart.
Wetin don happun so far?
Afta plenti tori and questions fly upandan about di death of 27-year-old Mohbad, di Nigeria Police Force come out sharp sharp to assure family, friends and fans of late Nigerian singer say dem go chook eye for di mata.
Plenty speculations and questions don spread for social media wey allege say di singer no die natural death as one petition wey e allegedly report to di police about threat on im life bin spread for social media.















