Why Ghana forwards dey misfire for Blackstars but dey shine for dia clubs

Semenyo x Kudus x Inaki collage

Wia dis foto come from, JACQUES FEENEY VIA GETTY/KARL BRIDGEMAN UEFA VIA GETTY/BRUNO PENAS QUALITY SPORT IMAGES VIA GETTY

Wetin we call dis foto, Semenyo and Kudus dey in fine form for dia clubs wey dem score goals wit assists ova di weekend
    • Author, Komla Adom
    • Role, Senior Journalist, BBC Pidgin
    • Reporting from, Accra
  • Read am in 7 mins

Ghana dey prepare for di final leg of di 2026 World Cup qualifiers wit games against Central African Republic and Comoros.

Even though di Blackstars dey lead Group I wit 19 points, Madagascar get 16, Comoros wit 15, Mali get 12, football fans dey worry if Ghana fit qualify.

Di fans also dey bash di players say dem no dey show enough commitment and passion wenever dem wear di Ghana jersey.

For di away game against Chad wey be di whipping boys for di group, Ghana drop points - fans and critics blast di team say dem complicate tins for di qualification.

Wit di upcoming games, coach Otto Addo invite di regular top players wey dey shine for dia clubs, but fans still dey worry wen dis players go deliver some of di performance dem dey show for dia clubs.

Many players score goals for dia clubs dis weekend

  • Antoine Semenyo - Di Bournemouth striker score two goals wit one assist vs Fulham ova di weekend. E win man-of-the-match wit dat performance. Di 25-year-old now get six goals and three assists so far for di premier league. E tok BBC sports say he dey "di form of his life".

But for Blackstars Jersey, Semenyo score only three goals wit one assist from 27 games.

Ghana coach Otto Addo afta di 1-0 win vs Mali in di last qualifier explain why Semenyo dey struggle wit di Blackstars.

"E bi difficult to compare games from Ghana and Africa wit premier league games. All di games get dia own nature, dem be different."

"Semenyo dey shine for premier league but for me even though he no score in dat Mali game, e play well," coach Otto Addo tok.

  • Mohammed Kudus - Di Tottenham forward score di winning goal v Leeds United ova di weekend wey e also get one assist.

So far di 25-year-old get one goal and four assists dis season.

Former England striker Wayne Rooney tok for BBC Match of di day show say "Kudus be breath of fresh air, wey e go impact Tottenham dis season."

Kudus score two goals to draw 2-2 against Egypt for di 2023 Afcon for Ivory Coast.

Afta dat, di former Westham player struggle to score goals for Ghana until 24 March 2025 when he score for 3-0 win vs Madagascar.

Kudus get 12 goals for di Blackstars from 44 games.

kudus and jordan ayew during a blackstars game

Wia dis foto come from, GFA

Wetin we call dis foto, So far di 25-year-old get one goal and four assists dis season for Tottenham
  • Inaki Williams - Di Athletic Bilbao captain dey struggle anytime e play for di Blackstars. Since im debut, e score only two goals - against Madagascar in 2023 and Central African Republic in June 2024.

Inaki be one of di biggest stars for di Spanish club - e score 100 goals in 481 official games.

Di 31-year-old end im nine-game goal drought for di club wit di goal to secure three points vs Mallorca (2-1) ova di weekend.

Inaki dey prepare to join di blackstars team for di upcoming games when Athletic Club announce say he pick up injury for dat game.

Di 31-year-old striker go miss di two upcoming games but fans go hope say somehow, he go fit shine for di blackstars when he return.

  • Abdul Fatawu Issahaku - Di winger score anoda solo goal to win di game v Swansea City (3-1) ova di weekend.

Dat be im third goal for championship side Leicester City dis season.

Issahaku dey in line to start for di blackstars v Central African Republic on im return to di team afta long injury lay-off (ACL injury).

E get two goals in 24 games for Ghana since im debut in October 2021.

  • Brandon Thomas-Asante - Di striker score two goals as Coventry City fire Sheffield Wednesday 5-0 ova di weekend.

Asante now get five goals and three assists from nine league Championship games dis season.

Di 26-year-old striker score one goal in four games for Ghana.

Coach Otto Addo invite am to replace di injured Inaki Williams for di upcoming games.

inaki and salisu celebrate Inaki's goal

Wia dis foto come from, GFA

Wetin we call dis foto, Inaki be one of di biggest stars for di Spanish club - Athletic Club wey he score 100 goals in 481 official games.
  • Jordan Ayew - Di Blackstars captain no score for Leicester dis season apart from di pre-season goal vs Fiorentina on 4 August 2025 and odas bifor di start of di season.

Di 34-year-old striker get six goals in 35 games for Leicester City wey im get 32 goals from 115 games for Ghana.

For di World Cup qualifiers, Jordan Ayew dey third for di top scorers' chart wit six goals.

Denis Bouanga from Gabon get eight goals followed by Mohammed Salah of Egypt wit seven goals.

But Jordan be di player among di blackstars frontline wey dey score and deliver for di Ghana jersey.

From di form wey dis players get, e for be easy for Ghana to blow teams apart, but dat no be di case.

Some of di forwards continue to struggle. But wetin dey cause am?

Wetin dey cause di players to misfire for Ghana?

For many football fans, di reason be poor coaching.

Football fan Robert Kuegbesika say "di tactics of di coach no dey allow players to explore."

"Antoine Semenyo be dat guy. Our best player."

"E dey play any position behind di striker for Bournemouth, wey he dey fit switch positions but for di Blackstars, dem dey pin am down to either di left or right side di whole game."

Robert tok BBC Pidgin say "di coach no dey stamp authority. He for insist on team work no be individual play sake of most of di players wan outshine each other wey dem dey forget about di team."

Anoda supporter Joshua Agomor explain say "sometimes di coaches dey demand different tins from di players - what di Bournemouth coach dey demand from Semenyo for example no be di same tin Otto Addo dey demand."

"Sometimes coaches dey build dia tactics around certain players wey go make dem either get more or less or di ball, some coach go tok say make player shoot, another one go tok say make dem move di ball around and get more touches, dis tins dey affect players," Joshua Agomor tok BBC Pidgin.

Some fans also blast Mohammed Kudus and oda key players say dem no dey release some of di balls quick enough.

full set of blackstars team before a game

Wia dis foto come from, GFA

Wetin we call dis foto, Ghana dey lead Group I wit 19 points from eight games.

Football analysts also believe say, ibi more than just di players and di coaches.

Kelvin Owusu Ansah wey be presenter wit Sporty FM say "di quality of players for club level dey different from di quality for di national team, so dis tins fit happen."

E explain say "sometimes you fit blame di poor show on di fact say di national team players no dey familiar wit each oda sake of dem get only two or three days to train. Dis no be enough to understand timing, movement and player positioning."

Kelvin also for interview wit BBC Pidgin tok say oda factors like di state of di pitch, di ball as well as di tactics of di coach all dey come togeda to affect di quality of di performance of di players.

"Di Ghana team dey play conservative football wey dem no dey open up to play fine football; dis dey limit di chances di team dey create, dat too dey affect di players."

Despite all dis factors, analyst no dey rule out di role of di players themselves.

"Decision-making by some of di players be terrible, especially when dey reach di final third of di park. You fit see say sometimes dia level dey drop when dem dey national team duty," Kelvin Owusu Ansah add.

For oda analysts like Saddik Adams, poor team management, lack of planning and weak team organization also dey affect di output of di team, which gatz to change if di team go qualify and do well for di 2026 World Cup afta dem fail to qualify for di Afcon for di first time in 21 years.

Full squad to face CAR and Comoros

Goalkeepers - Benjamin Asare (Hearts of Oak), Lawrence Ati Zigi (St. Gallen), Joseph Anang (St. Patrick's Athletic)

Defenders - Alidu Seidu (Stade Rennes), Gideon Mensah (Auxerre), Mohammed Salisu (Monaco), Jerome Opoku (Istanbul Basaksehir), Kojo Peprah Oppong (OGC Nice), Caleb Yirenkyi (FC Nordsjaelland), Jonas Adjetey (FC Basel), Ebenezer Annan (AS Saint-Etienne), Alexander Djiku (Spartak Moscow)

Midfielders - Elisha Owusu (Auxerre), Thomas Partey (Villarreal), Kwasi Sibo (Real Oviedo), Prince Owusu (Medeama SC), Mohammed Kudus (Tottenham Hotspur)

Forwards - Abdul Fatawu Issahaku (Leicester), Jordan Ayew (Leicester), Joseph Paintsil (La Galaxy), Christopher Bonsu Baah (Al Qadsiah), Kamaldeen Sulemana (Atalanta), (Thomas Brandon-Asante (Coventry City), Antoine Semenyo (Bournemouth)

Di team go play vs Central Africa republic on Wednesday 8 October for Morocco at 4 PM (GMT) bifor dem go host Comoros for di Accra sports stadium on Sunday 12 October 2025 at 7PM (GMT)