Mount Everest blizzard: Ova 200 hikers don hook for world tallest mountain

Ova 200 hikers don hook sake of blizzard for di Tibet side of di slopes of Mount Everest.
According to di Chinese state media, authorities don reach out to all of dem and tori be say rescuers don lead about 350 of dem go safety.
One of di hikers wey bin dey caught by di blizzard tell BBC say "I dey very lucky say I comot"
Heavy snow block hundreds of tourist road as dem bin dey trek for di Tibetan valley wey dey lead to di eastern side of Mount Everest during di weekend as China dey start dia eight days national holiday.
One camper say e bin need to clear di snow for outside im tent evri 10 minutes and one guide tok say di snowfall no dis high normally for dis time of year.
For di south of Tibet, di same storm wey cause di blizzard also cause sever flooding and landslides for Nepal wey kill at least 47 pipo.
Dis blizzard catch many mountain guides by surprise on top say October na normally one of di top times wey pipo go try climb mount Everest sake of say di temperature dey beta and sky dey clear.
As at now hundreds of local pipo for di area and rescuers na im dem don send go di area to clear di snow wey dey block di hikers for dia.
Some of di rescuers sef carry di pipo wey dem bin dey rescue for back to bring dem down from di site of di heavy snow.
Pipo wey bin dey rescued for the side of di mountain wey dem hook dey reveal dia fears as dem hook for di mountain and wetin dem dey fear say fit still happun to dem.
Eric Wen wey bin dey for group of 18 hikers tell Reuters tori pipo say dem decide say dem go comot dia camp bicos of di constant snowfall.
E tok say dem bin no fit even see Everest at all and three pipo wey be two men and one woman catch hypothermia even though dem wear di correct clothes wey dem dey wear for di hile.
E add say ova 10 of dem bin dey one large tent and no sleep well bicos dem bin dey clear snow evri 10 minutes so dia tents no go collapse.
Anoda pesin wey bin say sleep bin hear na one woman from di southern Chinese city of Shenzhen wey no gree tok her name wey bin dey try find her husband afta e go for 12 days of waka for di eastern slope of Everest.
Afta one week her husband call am wit Satellite say say heavy snow block dem for Oga Campsite for di Karma Valley.
She tell tori pipo say her husband bin dey fear to sleep fully sake of say snow fit bury am under.

Wia dis foto come from, Dong Shuchang
Dong Shuchang, 27 wey be nature photographer dem bin fry soaked from all di snow and wen dem come to rescue im and im group e just dey fall down dey go bicos of di ice.
E tok say di hotel wia e go afta e comot di snowed in trail bin no get light or water till dem comot for morning, say even di phone signal for dia dey limited.
According to di Schenzen woman, di snow thick sotay even rescuers no fit clear di route by demselves.
She say dem bin use dia animals dey to take create way wia dem seem to be no way for di side of di moutain.
How dangerous Mount Everest be?

Wia dis foto come from, Reuters
Mount Everest na one of di top gains for climbs but to reach di height of di highest mountain for world get risk.
Tori be say ova 280 pipo don die for di mountain, most of which dey come from avalanches or if pesin fall.
Oda causes of deaths for id mountain na acute mountain sickness, wey get symptoms of dizziness, vomiting and headaches.
Di hikers wey snowstorm block bin dey for di Tibetan slope on dia way to Mount Everest.
Dem bin dey waka through di Karma Valley for Tibet wey one Everest explorer call one of di most beautiful valleys for world.
No be very popular trail for di bottom of di mountain and according to hiking guidebooks say for pesin to waka dat way, dem need to get medium to high level of mountaineering experience and fitness.
But bifor you fit go anywia you gatz get permits and guides wey dey heavily regulated.









