Why some regions still dey pay less money to get Nigerian passport

Di Nigeria Immigration Service (NIS) don deny accuse say dem dey discriminate on top passport charges across di different regions of di kontri.

Dis dey follow di gbas-gbos wey di agency receive on social media afta e reveal say Nigerians for di South of di kontri dey pay more money to process di Nigerian passport pass di pipo wey dey di north of di kontri.

Pipo share screenshot of how di prices for di issuance of Nigerian passport dey different.

Di Nigeria immigration service give details on why di prices different

For one long post on dia Twitter page, di immigration office explain wetin cause di difference in prices.

For di statement, wey dem credit to di Comproller General of di agency Isah Jere Idris, e say di allegation dey laughable because di agency no dey consider di state of residence of di applicants before dem issue passport give am.

"Di Passports we dey issue na for Nigerians no mata wia dem dey live even for di diaspora", di Nigeria Immigration Service tok.

Add am say dem get two passport regimes wey dey run togeda - electronic Passport and enhanced electronic Passport.

Dem tok say di latter na improvement of di former. Say na product of di latest technology for Passport issuance.

E get improved security features, one poly carbonate data page and e dey come in three categories

  • 32-page five-year validity (N25,000),
  • 64-page five- year (N35000) and
  • 64-page ten-year validity (N70000).

Dem unveil di enhanced electronic passport for 2019 and since then seven passport centres na im don migrate to di regime.

Di centres na Ikoyi, Abuja, Alausa, FESTAC, Portharcourt. Kano and Gwagwalada.

NIS explain say di electronic Passport na di usual one wey dem don dey issue since di introduction of ePassport for 2007.

Di amount for dat one dey range na N8750-N17800 depending on age of di applicant and category of Passport.

Dem tok say for di moment, di Service dey steadily migrate all im Passport Centres to di enhanced ePassport regime.

To dis effect, all di Centres for South-South, South-West plus South-East plus dis desk for di UK and USA don fully migrate to di enhanced regime.

Dem tok say for di work plan, dia centres for di North-West, North-East, Canada and others dey ready for migration to di enhanced Passport regime very soon.